Nigerian military amnesty program for bandits fit stop security wahala for northwest?

Wia dis foto come from, Getty Images
As Nigeria Defence Headquarters don launch Amnesty program wey dem call (Tudun Mun Tsira) for Zamfara State and oda north-western states for bandits wey wan surrender, many pipo dey wonder if dis plan go fit help stop di security wahala wey dey worry di kontri.
Tori wey reach us tok say Tudun Mun Tsira na one special military program wey go help repentant insurgents and bandits enter back inside society.
Di program get five main steps: make di bandits drop dia guns, comot from bad gang, change dia bad mindset, rearrange dia life, and join dia community again.
Sulaiman Bala Idris, wey be Zamfara State Govnor tok-tok pesin, tell BBC say dem launch dis program to give chance to bandits wey don tire and wan find way to surrender.
E tok say, "For any war, once di enemy don dey lose ground and di fight don near end, dem go give chance to di ones wey wan surrender.
"Right now, e be like say we don weaken di bandits for Zamfara well well. Plenty don scatter, some don run leave dia family and property. Pipo like dis fit get chance to come surrender."
Sulaiman Bala Idris tok say some pipo go tink say na peace agreement dem dey do wit di bandits, but e no be so. Instead, na di bandits dey find way to surrender sake of dem no fit continue di fight again.
E tok say, "Pipo wey go fit stay for di program na di bandits wey get wife and pikin becos even for war, dem no dey kill women and children. Na dem we wan help, no be di big oga for bandit work."
"No be say we go carry pesin like Turji (one notorious bandit leader) kon go settle am for di program. Make pipo understand dis one. Some big bandit leaders dey wey even if dem surrender, e no mean say dem go accept dem inside di program."
Dis program na federal goment plan wey dem do wit Zamfara State goment and oda northwest states.
Di program na for bandits wey don tire for di wahala, wey wan find beta life. Dem go drop dia guns, kon get place wey dem and dia family fit stay witout condition.
Di security wahala wey dey face Nigeria, especially di ones wey bandits dey cause, na serious problem.
Di authorities for Nigeria dey tok say dem dey try dia best to stop di crisis, especially di bandit attacks wey dey happun steady for northwest states like Zamfara, Katsina, Sokoto, and Kaduna.
Zamfara na one of di states wey bandit wahala strong well well. Dem dey enter villages, dey kill pipo, kidnap for ransom, and even dey carry farm produce wey farmers plant.
BBC reach out to di military for comment but dem neva respond to dis tori.
Wetin be di implication?
Experts dey see dis move as beta step wey fit help bring peace for di region, especially if dem do di program well.
Security expert Dr. Auwal Abdullahi Aliyu for Nigeria tell BBC News Pidgin say dis plan get two sides, advantage and disadvantage.
"First, e good if di pipo wey dem give amnesty wey dey do kidnapping, killing, and raping drop dia weapons and help securities catch di bandits wey dey disturb innocent pipo for di region.
"Dis go help reduce di number of terrorists wey dey inside society," e tok.
But Dr. Aliyu still tok say if goment no take beta steps, e get serious wahala wey fit happun.
"Di problem be say, if pesin wey dem kidnap im family see say di bandits wey do di bad tin don get amnesty and dem don reintegrate dem inside society, e fit make am wan do revenge."
"Anybodi wey don pay ransom and still lose im family member go feel say goment no do anytin to help am. If e kon see say di same criminals wey cause am pain don come back dey live normal life, e fit wan take action by imsef."
E add say goment suppose reason how dem go take compensate pipo wey suffer loss, so wahala no go burst.
"Plenty pipo dey sell dia property just to find money take free dia relatives from kidnappers.
"Goment need to pay dem back wetin dem lose or find way to support dem, so wahala no go dey wen dis kain pipo wey dem forgive start to live inside society again," Dr. Aliyu tok.










