Nigeria National Security Adviser blast Canada after dem deny im kontri top military officer and odas visa

Wia dis foto come from, Nuhu Ribadu/X, Defence Headquarters
Nigeria National Security Adviser Nuhu Ribadu don blast Canada after dem deny im kontri top military officer, di Chief of Defence Staff, General Christopher Musa and some oda military officers visa to Canada.
Di Chief of Defence Staff make di revelation for one security event on Thursday, 13 February for Abuja, di kontri capital, e bin explain how Canadian embassy deny im and oda military officers visa to attend one event wey dem dey invited to.
Di event na to honour war veterans wey suffer injury as dem dey fight to defend dia kontris during battles.
However, di General say di Canadian embassy grant half of im team visa and deny di odas, and im no understand why.
"Remember last year di Duke of Sussex and im wife visit Nigeria. Through di Invictus, dem get one foundation wey dey raise di morale of troops all ova di world wey don suffer one deformed or di oda sake of say dem dey defend dia individual kontris. We suppose dey there. Half of my team don already go, but di Canadian embassy for knowledge best known to dem deny us visa.
"E dey very disappointing," Gen. Musa tok.
Di CDS add say dis na clear reminder say Nigeria dey on im own and must stand as a nation, so dat nobody go take dem for granted.
Di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, wey dey di event wen im take di stage react to di tori, come lambast di Canadian goment for di denial.
E describe di visa denial palava as "disrespectful".
"Thank you for di courage to say Canada deny you visas. Dem fit go to hell, even though e dey painful and disrespectful, but we be pipo, we dey strong, and I agree wit you, we gatz fix our kontri, and we gatz do am well.
Dis disrespect don dey too much, and dis na yet anoda reason why we gatz work hard to make Nigeria work and be respected." Di NSA tok
Canadian embassy neva comment on di mata.
However, dis dey come as Canada dey tighten dia immigration policy rules wey dey intended to reduce di number of pipo wey dey apply to stay for di kontri.
Plenty reactions don follow dis visa denial mata, as some Nigerians hail di NSA for im tough tok, odas say dis na wake up call for Nigeria leaders to fix di kontri.
One former minister of aviation, Femi Fani Kayode wey follow chook mouth on di tori say, "at last we get NSA wey get liver and dey prepared to stand up to foreigners wey treat our pipo anyhow.
Di days wey foreign goments go take kick us for teeth and go away wit am don end," e tok.
Anoda former top goment official Bashir Ahmad say dis na clear reminder say Nigeria must stand on im own, strong, resilient, and unapologetic.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Screengrab from X
Why Canada fit deny entry to dia kontri
E neva dey clear why di Canadian embassy deny Nigeria Chief of Defense staff and some of im team visa to di kontri, as di reason for di visit na to attend di Invictus Games, wey Nigeria dey follow participate in.
According to di CDS, half of di team don already dey dia, and dem deny di oda half visa.
However, Canada Immigration on dia website tok reasons why dem fit deny pesin entry to dia kontri, wey include security, human or international rights violations, medical, financial reasons, among odas.
Security reasons, including:
- spying
- subversion (attempts to overthrow a government, etc.)
- violence or terrorism
- membership for organization wey dey do any of these.
Human or international rights violations, including:
- war crimes
- crimes against humanity
- wen you be senior official inside government wey dey engaged in gross human rights violations or subject to international sanctions.
Smuggling or money laundering
Medical reasons: Dis one include medical conditions wey go:
- endanger public health
- endanger public safety
- cause too much demand on heath or social services
Financial reasons: If you no fit support yourself and your family members wey wan travel enter di kontri.










