Why Diddy dey sue TV network NBC for $100m

Sean "Diddy" Combs speak during di Congressional Black Caucus Foundation Annual Legislative Conference National Town Hall on September 21, 2023 for Washington, DC

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Steven McIntosh
    • Role, Entertainment reporter
  • Read am in 3 mins

Rapper Sean "Diddy" Combs don file a $100m (£80.5m) lawsuit against pipo wey make one recent documentary about am, as im kotinu to face allegations of sexual assault.

Di rapper currently dey New York jail wia im dey wait for im federal criminal trial on sex trafficking and racketeering charges, wey im don deny.

On Wednesday, Diddy lawyer say im go sue TV network NBC, dia streaming service Peacock and production company Ample ova dia documentary Diddy: Di Making of a Bad Boy.

Di legal action allege say di documentary feature untrue and defamatory statements about di rapper. Di three companies neva comment on di mata.

Di lawsuit say di "entire premise of di documentary assume say Oga Combs bin commit plenti terrible crimes, including serial murder, rape of minors, and sex trafficking of minors".

E say di programme "maliciously and baselessly jump to di conclusion say Oga Combs na 'monster'", and include claims say di makers "know say na false or published wit reckless disregard as to whether dem dey false or not".

Diddy dey seek $100m in damages for di "reputational and economic harm" wey di documentary don cause.

Di lawsuit say di programme "falsely, recklessly, and maliciously accuse Oga Combs of murdering" figures around am including former partner Kim Porter and rapper Christopher Wallace, known as Biggie Smalls and di Notorious BIG.

Oga Combs lawyer Erica Wolff say NBC, Peacock and Ample "bin make conscious decision to line dia own pockets at di expense of truth, decency, and basic standards of professional journalism".

Dem "maliciously and recklessly broadcast ogbonge lies", she tok for statement.

BBC News don ask NBC and Ample for comment.

Di lawsuit dey come afta both men and women make several allegations against di rapper ova di past 16 months.

Tori be say currently, na more dan 30 separate civil lawsuits dey against am.

Di star dey accused of kidnapping, drugging and pressuring women into sexual activities, sometimes through di use of firearms and threats of violence. Diddy also dey accused of assaulting and raping pipo.

Earlier dis month, one lawyer wey represent plenti of di accusers say im dey expect Diddy to face more dan 10 new civil lawsuits in addition to those wey dem file before.

Last week, BBC publish one investigation afta dem speak to more dan 20 pipo wey bin work wit Diddy for im Bad Boy Records, dem describe troubling incidents wey dem say dem witness during 1990s wen di label dey rise.

Oga Combs don consistently deny di allegations for di lawsuits, and im bin don call dem "sickening". Im don plead not guilty to di criminal charges.

For one previous statement to BBC, Oga Combs lawyer say: "For court, di truth go prevail: say Oga Combs never sexually assault or trafficked anyone - man or woman, adult or minor before."