My son no be monster, P Diddy mama tok

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Mark Savage
- Role, Music Correspondent
- Read am in 4 mins
Sean "Diddy" Combs' mama don tok say she dey "shocked and really sad" by di allegations wey dem level against her son, but say dem be "lies".
Di musician, wey dey popular for im hits like 1997 I'll Be Missing You, dey arrested on charges of sex trafficking and racketeering last month. E currently dey Manhattan detention centre wia dem hold am, afta im bail dey denied.
For one statement, Janice Small Combs bin defend her son, say although e don "make mistakes for past, as all of us don do", e "no be monster wey dey don paint am to be".
"E dey heart-breaking to see my son dey judged not for di truth, but for one narrative wey dey created out of lies," she write.
Dem say na Ms Small Combs and the Combs family get di statement, wey her lawyer, Natlie G Figgers issue.
E bin come five days afta e show say Oga Combs fit face lawsuits from moredan 100 additional accusers, both men and women, for alleged sexual assault, rape and sexual exploitation.
Di star lawyer don deny dis and all charges wey dey bifor, e call dem "false and defamatory".
E don face some number of cases since last year, wen im former partner Cassie Ventura bin accuse am of rape and abuse.
Oga Combs bin deny di allegations, and di case bin dey settled out of court one day afta dem file am.
However, afta e dey sued by12 oda women, many of wey accuse di rapper say e drug and assault dem.
Federal agents bin raid im properties for March as authorities build one criminal case against di star.
Den for May, one video of Oga Combs physically dey assault Ms Ventura for hotel room for 2016 leak to di press.
For her statement, Ms Small Combs bin reference di video, say she no "no dey here to portray my son as perfect sake of say e no perfect".
"My son fit no don dey entirely truthful about some tins, like how e deny say e don ever dey violent wit one ex-girlfriend wen di hotel surveillance bin show otherwise," she tok.
"Sometimes, di truth and one lie go become so closely twisted sotey fear go dey to admit one part of di tori, especially wen dat truth dey outside di normal or e dey too complicated to believe.
"Dis na why I believe say my son civil legal team bin choose to settle di ex-girlfriend lawsuit instead to contest am until di end, dis one affect as di federal govment bin use dis decision against my son and interpret am as admission of guilt."
Oga Combs bifor don apologise for di incident wey dem catch for film, say: "I take full responsibility for my actions for dat video. I dey disgusted den wen I bin do am. I dey disgusted now."

Wia dis foto come from, Getty Images
To conclude her statement, Janice Small Combs bin argue say one lie no make am guilty of all di oda "repulsive allegations and di serious charges dem level against am".
"E dey truly agonizing to watch di world turn against my son so quickly and easily over lies and misconceptions, without ever hearing im side or afford am di opportunity to present im side," she tok and add say she believe some of im accusers dey motivated by money.
Oga Combs next dey due for court on Wednesday, 9 October, wen im lawyers go argue for am to dey released on bail.
E bin first dey denied bail afta prosecutors argue say "na serious risk" to di forthcoming trial.
Dey bin tell one New York judge say Oga Combs don "already try to block di govment investigation of dis case, repeatedly dey contact victims and witnesses and feed dem false narratives of events".










