Munich car attack suspect wey jam and injure plenti pipo don dey identified as asylum seeker

Two emergency service workers dey inspect one damaged white mini cooper.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Officials tok say dem don detain di driver for di scene of di incident
Read am in 4 mins

Police don identify one 24-year-old Afghan asylum seeker as di driver and suspect wey drive one car and jam some group of pipo for Munich, Germany.

At least 28 pipo injure, two pipo case worse, police tok.

Local fire service tok say some of di pipo wey injure dey for "life-threatening condition".

Dem don arrest di suspect for di scene and e no dey try carry out more risk, di police add.

German Chancellor Olaf Scholz tell tori pipo say: "Dis attacker no go fit count on any mercy. E must dey punished and e must leave di kontri."

Di Munich incident dey come afta string of attacks for Germany, wey involve suspects wey be asylum seekers. E also dey come for time of serious debate around asylum rules.

Centre-right and far-right political parties for Germany don promise tough action on migrant crime.

How di incident take happun

Officers dey inspect di car - one cream mini cooper wey di boot dey opened

Wia dis foto come from, Getty Images

Di accident happun for di scene of one rally wey dem link to di transport union, Verdi, for around 10:30 local time (09:30 GMT) according to local media.

Pipo see as di car dey approach police cars for di rally, bifor e speed and drive jam one group of pipo, police tok. Police come shoot di vehicle bifor dem detain di man.

One police tok-tok pesin tell broadcaster BR say officers dey check weda link dey to di demonstration.

Munich mayor Dieter Reiter say children dey among those wey injure.

Authorities don begin one major operation for di Dachauer Strasse area, near di German city central train station.

Eyewitnesses tell BBC say dem see pipo dey run go hide for inside shops and residential buildings as di "distressing" scene happun.

"E dey very disturbing," one witness, wey be student wey bin dey study for one nearby coffee shop tok.

"I no fit concentrate on anything."

Pipo wey injure don dey receive treatment and rescue helicopters dey for di scene of di accident.

Bavaria Premier Markus Söder call di incident "suspected attack".

"Something need to change something for Germany – and quickly," e tok.

"Wen you hear news say pesin don once again drive car enta wear crowd of pipo dey, di fact say many pipo injure na slap in di face.

"We go clear all di details, but we dey react carefully to every attack wey be like dis."

Police tok say dem no fit confam if anyone else dey involved, following unconfirmed reports say anoda pesin dey di car.

Police sabi di suspect for theft and drug offences, officials tok.

Di incident happun hours bifor world leaders wey include Ukraine President Zelensky and US Vice President JD Vance go arrive for di city for di Munich security conference, wey go hold on Friday, though local authorities say dem no believe say di incident dey linked to di conference.

E happun around 1.5 kilometres (1 mile) from di security conference venue, and dem don advise pipo to avoid di scene, wey dem don seal off.

Police say make eyewitnesses come forward wit information and footage of di incident.

Di suspected attack dey come 10 days bifor Germany federal election, wia di mata of security don become central issue, and e follow some violent attacks for di kontri.

Munich Mayor repeat am say foreign pipo wey commit crime for Germany no fit continue to stay for Germany, plus im goment go resume deportations to Afghanistan for August.

For December, six pipo die and nearly 300 injure wen one car speed enta inside one German Christmas market for Magdeburg. Di suspect, na Saudi man and outspoken critic of Islam, wey dem grant asylum for 2016.