Teacher allegedly stab eight-year-old for elementary school

One man stand wit im hands cross for front of one school gate. Bouquets of flowers lay on di ground beside am.

Wia dis foto come from, News1

Wetin we call dis foto, Locals lay flowers for di school gate to mourn di eight-year-old student
    • Author, Koh Ewe
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

One teacher don allegedly stab one eight-year-old girl for one elementary school for South Korea, for incident wey shock di nation.

Police tok say di female teacher wey dey her 40s allegedly confess say true-true she stab di student in di central city of Daejeon.

Dem find di girl wit stab wounds on di second floor of one school building for18:00 local time (09:00 GMT) Monday and dey pronounced dead for hospital. Dem also find di teacher beside her wit stab wounds wey police say fit be self-inflicted.

South Korea acting president Choi Sang-mok on Tuesday order investigation into di matter and urge authorities to "implement necessary measures to make sure say dat kain incidents no happun again".

Join BBC Pidgin on WhatsApp

Some locals bin lay flowers and stuffed doll for di gate of di school, wey bin dey closed on Tuesday.

For one police briefing on Tuesday, Yook Jong-myung, di head of di Dajeon Western Police Station tok say di teacher currently dey recover for hospital, and add say she get wound on her neck and say dem don stitch am.

Di Daejeon education office earlier tok say di teacher bin request six-month leave of absence, as she bin cite depression on 9 December, but return to school just 20 days later afta one doctor assess her say she dey fit to work.

During her time off work, she bin get suicidal thoughts, Oga Yook tok, e cite one testimony wey di teacher bin provide to police.

Days bifor di stabbing, di teacher bin show violent behaviour, wey include how she allegedly put anoda teacher for her headlock, di education office tok.

Two officials from di education office bin visit di school on Monday, di morning of di stabbing, to investigate di matter.

Daejeon City South Korea

Afta di attack on di co-worker, di education office bin recommend say make dem put di teacher on leave and dey separated physically from di oda teacher.

Dem make her sit beside di vice principal desk so dat she go dey under close watch.

She bin don also no dey teach any class since her leave for December, and no get any contact wit di eight-year-old student, di official tok.

According to di testimony wey di teacher give to police, she bin don buy weapon on di day of di attack and bring am to school - di testimony add say she bin don plan to kill hersef along wit one child.

Di testimony bin go on to say dat di teacher no "care which child e be", and target di last to leave - she bin manage to "lure di child into di media room" bifor she allegedly attack dem.

Di student dey reported missing on Monday evening afta di bus driver inform di school say she never arrive for pick up dat day.

South Korea na one generally safe kontri wit strict gun control laws. But for recent years, dem don witness some high-profile crimes, including stabbings.

"E pain me to see dat kain incidents sake of say school suppose be our safest space," acting president Choi tok. "I offer my deep condolences to di victim family wey suffer great shock and agony."