Nigeria beat Ghana for corruption as island nation maintain status as least corrupt African kontri - CPI report

Wia dis foto come from, John Dramani Mahama/Facebook, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu/Facebook
Corruption Perception Index for 2024 wey Transparency International release on Tuesday 11 February show Nigeria as one of di most corrupt kontris for di world.
For di report, Nigeria score 26 out of 100 points and rank 140 out of 180.
Dis latest report show say Ghana score 42 out of 100 points and rank 80 out of 180. Wetin e mean be say Nigeria corrupt pass Ghana.
Oda kontris wey also score 26 points wit Nigeria include Cameroon Uganda, Mexico, Madagascar, and Iraq
For di report, Denmark na di least corrupt kontri as dem score 90 points. Finland na second as dem score 88 points, and Singapore come third as dem score 84 points.
Na European kontris dominate di top 10 veri clean list and no African kontri dey inside.
Meanwhile, na Seychelles top di list of least corrupt African kontris as dem get 72 points out of 100 and rank 80 out of 180.
Na Cabo Verde follow Seychelles for back as dem get 62 points out of 100 and rank 35 out of 180.
South Sudan, Somalia, and Venezuela na di most corrupt kontris for 2024.
"Di 2024 Corruption Perceptions Index (CPI) show say corruption na dangerous problem for evri part of di world, but change for di beta dey happun for many kontris," di chair of Transparency International, Francois Valeria, tok.
"Research also reveal say corruption na major threat to climate action. E dey hinder progress in reducing emissions and adapting to di unavoidable effects of global heating."
Di CPI dey rank 180 kontris and territories worldwide by dia perceived levels of public sector corruption.
Dem dey give di results on a scale of 0 (highly corrupt) to 100 (veri clean)."
Valeria tok say while 32 kontris don significantly reduce dia corruption levels since 2012, work still dey to do.
According to Valeria, 148 kontris don remain for di same spot or get worse.
"Di global average of 43 don stand still for years, while over two-thirds of kontris score below 50. Billions of pipo live in kontris wia corruption dey destroy lives and undermine human rights," Valeria tok.
How some African kontris perform
72. Seychelles
62. Cabo Verde
57. Botswana
57. Rwanda
51. Mauritius
49. Namibia
45. Benin
45. Côte d'Ivoire
45. São Tomé and Príncipe
45. Senegal
42. Ghana
41. Burkina Faso
41. South Africa
41. Tanzania
39. Tunisia
39. Zambia
38. Gambia
37. Ethiopia
37. Lesotho
37. Morocco
34. Algeria
34. Malawi
33. Sierra Leone
32. Angola
32. Kenya
32. Togo
31. Djibouti
28. Guinea
27. Eswatini
27. Gabon
27. Liberia
27. Mali
26. Cameroon
26. Madagascar
26. Nigeria
26. Uganda
25. Mozambique
24. Central African Republic
23. Congo
21. Chad
21. Comoros
21. Guinea-Bissau
21. Zimbabwe
20. Democratic Republic of the Congo
17. Burundi
15. Sudan
13. Equatorial Guinea
13. Eritrea
13. Libya
9. Somalia
8. South Sudan
Ten cleanest kontris wit best marks
90. Denmark
88. Finland
84. Singapore
83. New Zealand
81. Luxembourg
81. Norway
81. Switzerland
80. Sweden
78. Netherlands
77. Australia
Ten most corrupt kontris
8. South Sudan
9. Somalia
10. Venezuela
12. Syria
13. Yemen
13. Libya
13. Eritrea
13. Equatorial Guinea
14. Nicaragua
15. Sudan










