Bayelsa state govnor Diri address issue wit Nigeria currency, crack inside PDP and oda mata dem

Wetin we call dis Video,
Read am in 3 mins

Bayelsa state govnor say e prefer say di Nigerian naira get beta value as opposed to just salary increase.

Govnor Duoye Diri say strong currency make sense pass and wetin go make civil servant get value of wetin dem dey earn.

Di govnor tok dis one in reaction to di increase of minimum wage to 80,000 naira ($53.23) for im interview wit interview wit BBC News Pidgin for Yenegoa.

Oga Diri wey dey countdown to di first anniversary of im second tenure as govnor say im goment still more tins to achieve to beta di lives of Bayelsans.

"I no be fan of wage increase, to dey increase salary. Wetin I believe na make we bring back di value of our currency," e tok.

E add say Bifor pesin fit use one million naira go buy motor but today if you cari one million go, "I no know weda you fit buy keke sef or okada."

"But as tins dey increase, wetin di civil servant dey take home no reach again so di need to increase dia salary. But my advice na to bring back di value of our currency. Make e be say if you get one naira, make dat one naira dey equivalent to anoda pipo currency too." E tok.

Governors of Southern Nigerian with a rep from Edo state

Wia dis foto come from, Bayelsa Government New Media

Wetin we call dis foto, Gov Diri say South South governors dey join bodi plan ogbonge infrastructure wey go develop di south south region

Governor Diri wey also be di Chairman of di South South governors forum forum say e dey committed to bring lasting development for all di six states of di region.

Nigeria's oil industry dey dominated by small key states wey dey contribute to di oil and production. Di states na Bayelsa, Delta, Rivers and Akwa Ibom.

Diri say im focus na to especially collaborate to tighten security for di region, address road infrastructure wey go improve interstate trade and agricultural development as di south south states get common challenges.

"For di power sector, wetin stop us if we get a regional power hub? Like for Bayelsa now we dey try to build independent power plants wey go give us 24 hours power supply. Nobody go say NEPA don take light becos dat one na gas turbine and you know gas plenti for our land!"

"If we pull dis ones togeda, we fit even get a regional power hub wey go make 24 hours power supply for our south south region. And you know for investors to come, di number one tin na power. So na dat kain tin all of us dey plan as governors."

On di perceived cracks inside di Peoples Democratic Party, Governor Diri say dem dey work as a party to repair di cracks so dem go be a strong opposition for di kontri.