Authorities for Ghana give two weeks ultimatum to finish investigation afta student allegedly stab colleague to death

Father of the student that was stabbed to death in Ghana

Wia dis foto come from, Nobel Crosby Annan

Read am in 5 mins

Di Ghana Education Service (GES) say dem go finish investigation into di stabbing incident wey lead to di death of one student for O’Reilly Senior High School, in two weeks.

Dis na afta family of 18-year-old final year student wey dey don die, tok say di “school gatz give dem answers” ova di death.

Tori bin go round say Edward Sackey die as im get kwanta wit anoda student for campus wey turn fight on Monday as im and oda final year students dey write dia West African Senior School certificate exam (WASSCE).

Papa of di deceased say di student allegedly stab im pikin during a misunderstanding.

“As I go di hospital afta I receive one call say dem carry my pikin go dia, di doctor tok say im die. I see say im get three stab wounds for im chest,” Edward papa Enoch Sackey tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Im tell journalists afta im visit to di school say “di school neva tell us anytin. I bin dey here all day but dem carry police come di campus wey dem no dey tell us anytin".

“Di school gatz tok to me di papa of di pikin, di family of di oda boy wey (allegedly) kill my pikin too neva call me to tok anytin. Dis na sad tin.”

Enoch Sackey say im family go hold di school responsible ova di death of im son, sake of say dem sabi “protect our children on campus. If dis tin fit happun for dia, dem gatz explain to us. We go take legal action against dem”.

Father of the deceased and some relatives during the visit of the education service officials
Wetin we call dis foto, Di family of di 18-year-old final year student wey die say dem want justice for dia pikin

Afta one meeting on Tuesday afternoon,di regional director of education Stephen Abamfo bin tok day dem dey investigate di mata.

Im also tok say dem go put tins in place “to ensure safety of students and staff for di school”

Meanwhile, di student wey allegedly stab di deceased dey for di hand of di police.

Police pipo bin dey di campus of di school as some residents wey vex don try to attack di school ova di death.

Ghana Education Service officials visit di family

Photo of the director general of the Ghana education service as they visited the home of the deceased student
Wetin we call dis foto, Director general of di Ghana Education Service bin lead oda officials to commiserate wit di family of di final-year student wey die

Ogbonge pipo for di Ghana Education Service (GES) don visit di family of di deceased and “commiserate wit dem".

“Di incident wey lead to di tragic death of Edward Sackey dey sad. Our thoughts and condolence to di family wey lose dia pikin, dia friends and di entire school community,” one statement wey tok-tok pesin for di Ghana education service bin release tok.

Some reps of the Ghana education service as they paid a visit to the home of the deceased to commiserate with them
Wetin we call dis foto, Di education service assure di family say dem go finish dia administrative investigation in two weeks

Oga for di service Dr Eric Nkansah bin lead di delegation wey assure say dem don dey “work wit di relevant agencies to ensure say we investigate di mata well well".

“We hope to conclude our administrative investigation within two weeks while di police dey handle di criminal investigation.”

Di GES add for dia statement say “we dey pleased to announce say tins don calm for di school wey we don dey work to ensure say all students and staff of di school dey safe.”

Di service say dem go work “to prevent dis kain tin for schools for di kontri so dis campuses go be safe places for academic excellence”.

Papa of di deceased say dem go expect to hear sometin beta from di education service within di two weeks as dem prepare to take di mata to court.

National Association of Teachers bin react

Di Ghana National Association of Teachers (GNAT) say di incident dey sad.

Secretary of di association Thomas Musah bin describe di mata as "wake-up call for stakeholders say make dey take discipline for schools as serious mata".

Im tok say some of dis kain tin wia students go dey fight na problem wey dey happun sake of teachers neva get di power to maintain discipline for schools.

"Now teachers no fit to take proper action to maintain discipline for schools sake of di Ghana Education Service bin give rules wey don tie our hands."

Di general secretary say di education service gatz review dia policies and give di teachers for dis schools di support wey dem need to enforce discipline.

Students of di school dey traumatised

Afta di inicident, many students say dem dey traumatisee.

One student Aba (no be im real name) tok say she dey fear for im life for campus.

"Afta di fight happun, we don see some pipo for di area dey come dey threaten us inside di school. Right now, we neva sabi wetin fit happun next as we dey here dey write our exams."

Anoda student say im no dey di right frame of mind to continue to dey write di final exam.

Policemen according to local authorities go still dey for di campus to ensure say pipo no go attack di school.

Municipal chief executive for di Ledzokuku area, oga Mordecai Quarshie say dia priority go be to provide protection to di rest of di students as dem dey write dia exam.

Im add say beyond dat, "We dey offer counselling to di students sake of wetin happun na serious tin, at a time when dem dey write dia final exam."

"Just imagine how traumatic dis tin be, some of di students don write paper immediately afta di incident, you fit imagine wetin dey go thru dia mind. dat be why we dey ensure say di counselling go continue until dem finish dey write di exam," di municipal chief executive tell journalists for di family house.