Man chop accuse say im hire strangers to rape im wife for ova ten years

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Lucy Clarke-Billings
- Role, BBC News
- Read am in 4 mins
Dis tori contain some details wey fit turn your belle.
One man don dey on trial for France on top accuse say im repeatedly drug and raping im wife and also hire dozens of men to rape di woman.
Di defendant wey dem identify as 71-year-old Dominique P chop accuse say im recruit strangers online to come into im home and sexually assault di victim for ova ten years.
Di woman dey heavily sedated and she no dey aware of di repeat abuse, her lawyers tok.
Di case dey shock France for di mass scale of di grave crimes.
Police identify at least 92 rapes wey 72 men commit against di victim. Dem don identify and charge fifty pipo, and dem dey stand trial alongside di husband.
Di victim, now 72, only learn of di abuse for 2020 afta police inform am.
Di trial go be "horrible ordeal" for her, her lawyer Antoine Camus tok. Camus say dis go be di first time she go see video evidence of di abuse.
"For di first time, she go live through di rapes wey she don endure for ova 10 years," e tell AFP news agency.
Police bin investigate Dominique P afta one incident for September 2020 wen security guard catch am dey secretly film under di skirts of three women for shopping centre.

Wia dis foto come from, Getty Images
Police den find hundreds of pictures and videos of im wife for im computer, wia she appear to dey unconscious.
Di allege fotos dey show dozens of assaults in di couple home. Di abuse allegedly start for 2011.
Investigators also find chats on website wia Dominique P allegedly recruit strangers to come to dia home and rape im wife.
E admit to investigators say e dey give im wife powerful tranquilisers, including anxiety-reducing drug.
Dem accuse am say e take part for di rapes, filming dem and encouraging di oda men wey dey use degrading language, according to prosecutors.
No money dey alleged to dey involve.
Di accused rapists - wey dey between 26 and 74 years - come from all walks of life and while most of dem bin participate once, some take part up to six times, according to prosecutors.
Dia defence be say dem dey help di couple live out dia fantasies but Dominique P tell investigators say evri one dey aware say im wife don dey drugged witout her knowledge.
Expert say her state "dey closer to coma dan to sleep".
Dominique P, wey say dem rape am wen im bin dey nine, dey ready to face "im family and im wife", im lawyer Beatrice Zavarro tell news agency AFP.
Dem also bin charge am wit one 1991 murder and rape, e deny am, and one attempted rape for 1999, wey e admit afta DNA testing.
Di trial, wey dey hold for Parc des Expositions for Avignon, southern France, dey due to last until 20 December.
On Monday, di opening day of di trial, di woman turn up to court supported by her three children, AFP report.
Oga Camus, her lawyer, tok say she for ask for trial behind closed doors, but "dat na wetin her attackers go want".








