How rape and murder of one 31-year old female doctor for Indian hospital cause gbege

Wia dis foto come from, Getty Images
Tens of thousands of pipo participate for di "Reclaim di Night" march for Indian city of Kolkata on Wednesday night to protest against di rape and murder of a trainee doctor wey happun last week.
Na women lead di march wey dey demand justice for di 31-year-old victim wey bin dey work for di RG Kar Medical College before her death.
Dem brutally attack her on Friday, and e don cause kasala and anger across di kontri.
Devalina Bose, 27, one intern for di same hospital, tell di BBC say she bin join di protest as she dey hurt and angry becos of wetin happun to her colleague.
Dis na Devalina for her own words.
I still dey traumatised by wetin happun to di victim. I struggle to sleep for night.
I dey always think about how just three weeks back, I bin take a short nap for one of di rooms wey dey just a few meters away from wia di rape and murder bin happun.
I dey tired dat night afta I dey on my feet for hours and I bin just want sleep.
But di room no get any lock and so I no fit lock di door.
I dey alone for di room and, for some time, I worry about my safety.
But den, I bin push di thought comot for my head becos I tell myself say my colleagues dey close-by and nothing bad fit happun to me for hospital.
But now, I no dey feel dis way again.
Every time I dey shift, I dey catch myself looking ova my shoulder, to dey look di room for unsafe faces, voices… I no know wetin I dey look for but I dey always dey on guard.
Wetin happun to her na wetin we no fit imagine. How a doctor on duty dey subjected to sometin wey dey painful?
Doctors dey save pipo lives. Dey give pipo a second - sometimes a third chance for life.
So last night, I bin join all my colleagues for di street. My parents no want make I participate for di march becos dem dey worry about my safety.
But I tell dem say make dem encourage me instead, becos women get di right to dey out for di streets at night and to feel safe.

Wia dis foto come from, Getty Images
Women get di right to dey anywia wey dem choose to, to do wateva dem choose to, wey dem no go worry about dia safety.
We get a right to di night like anybody else.
Na why I bin join di protest. To mark dis idea and to force pipo to see am, understand am and believe am.
I bin see so many pipo, of all ages wey dey participate for di march.
E get several generations of women wey dey for streets - grandmothers, mothers, daughters wey hold placards, candles, shouting slogans for justice and change.
Some just dey walk along silently, dem dey try think wetin don happun.
My female professors and staff from di hospital also come out to protest.
Na di first time I see pipo wey I see pipo wey I neva think say dem go fit even participate for march.
I bin think say e dey so special and so powerful.
I walk along wit my female friends and even though I bin attend just one protest march, I feel di connect to di hundreds of marches wey dey hold for di same time across di state.
For dos few moments, we all feel di connection as we dey united for our anger and desire for change.
I think dis incident don ginger us so much wit anger and e touch so many pipo.
Wetin happun for Kolkata hospital
Junior doctors across West Bengal down tool on Wednesday, di sixth day, protesting di alleged rape and murder of di woman doctor for di state-run medical college and hospital wey be di oldest hospitals for India.
Early Friday morning, di doctor bin go sleep for one of di seminar hall wey dey di hospital.
Sadly, na di last time wey dem see her alive be dat.
For early morning, her colleagues discover her half-naked deadi body for di podium of di hall.
Her body bin get plenti injuries and police later find out say na case of rape and murder.
Di police bin arrest one hospital volunteer worker wey dem say dey in connection wit di case for di 138-year-old RG Kar Medical College for Kolkata, India.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Doctors across different cities for India don comot work to ask for federal law wey go protect dem and give dem "independence to live in freedom and without fear".
Dis protest happun just bifor di India Independence Day on Thursday.
Dis very sad incident don bring back di issue of di violence against doctors and nurses for India.
Reports of doctors, regardless of dia gender, wey patients and dia relatives dey abuse don gain serious attention.
According to data, women wey dey make up nearly 30% of India doctors and 80% of di nursing staff dey more vulnerable dan dia male colleagues.
Di crime for Kolkata hospital last week don also expose di alarming security risk wey medical staff dey face for many health facilities in India.
For RG Kar Hospital, wey dey get ova 3,500 patients everyday. Di trainee doctors dey always overwork and some dey work up to 36 hours straight.
But dem no get separate rooms wia dem fit rest and dem need to go di third-floor seminar room to go rest.

Wia dis foto come from, Getty Images
Who be di suspect
Reports indicate say di suspect wey dem don arrest na volunteer worker wey get troubled past.
Di suspect also get access to di ward and CCTV bin capture am.
Police allege say no background checks bin dey conducted on di volunteer bifor e begin work for di hospital.
"Di hospital na our first home; we dey only go home to rest. We no eva imagine say e fit dey unsafe. Now, afta dis incident, we dey fear," Madhuparna Nandi, wey be junior doctor for Kolkata 76-year-old National Medical College tok.
Dr Nandi own journey dey show how female doctors for India govment hospitals dey work for conditions wey dey put dia security at risk.
For her hospital wia she be resident for gynaecology and obstetrics, dem no get separate room to rest and no separate toilets for female doctors.
“I dey use di patients or di nurses toilets if dem allow me. Wen I work late, I dey sometimes sleep for empty patient bed for di ward or for one waiting room wey get bed and basin,” Dr Nandi tok.
She say she dey feel unsafe even for di room wia she dey rest afta 24-hour shift wey dey start wit outpatient duty and continue round di ward and maternity rooms.
One night for 2021, during di time of di Covid pandemic, some men bin enta into her room and wake her by touching her, as dem say, “Get up, get up. See our patient.”
“Di incident make me shake. But we no eva imagined say e fit come to di point wia dem go rape and kill a doctor for di hospital,” Dr Nandi tok.
Cases of rape and murder wey don happun for India

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin happun to di young doctor on Friday no be di first wey don happun for India.
Di most shocking case na still dat of Aruna Shanbaug, one nurse for one ogbonge Mumbai hospital, wey dey in a vegetative state afta one ward attendant bin rape and strangle her for 1973. She die for 2015, after 42 years of severe brain damage and paralysis.
Di one wey dey recent na di one wey happun for Kerala (one of di cities) wia one drunk patient bin stab one 23-year-old medical intern identified as Vandana Das wit surgical scissors.
For overcrowded govment hospitals wey free access dey, doctors dey face serious attack from patients and dia relatives afta a death or sake of demands for immediate treatment.
Kamna Kakkar, one anaesthetist, remember anoda sad incident during night shift for di intensive care unit (ICU) during di pandemic for 2021 for her own hospital for Haryana northern India.
“I bin dey alone for di ICU wen three men, wey dey drop one politician name, enta wit force wia dem demand for a controlled drug. I accept to protect myself, and di safety of my patients bin dey at risk too," Dr Kakkar tok.
Namrata Mitra, one Kolkata-based pathologist wey study for di RG Kar Medical College, say her doctor father go always follow her go work becos she no dey feel safe.
“During my on-call duty, I carry my father wit me. Everyone bin laugh, but I get to sleep for one room wey dey for dark corridor wit locked iron gate wey be say na only nurse fit open am if patient come,” Dr Mitra write for Facebook post ova di weekend.
“I no dey ashamed to admit say I bin dey fear. Wetin go happun if pesin from di ward - attendant, or even a patient - try sometin? I take advantage of di fact say my father na doctor, but no be everyone get dat privilege.”
Wen she dey work for a public health centre for West Bengal, Dr Mitra spend nights for bad one-storey building wey dey serve as di doctor hostel.
“From dusk, a group of boys go gather around di house, wia dem go dey tok rubbish as we dey go in for emergencies. Dem go ask us to check dia blood pressure as an excuse to touch us and dem go look through di broken bathroom windows,” she write.
Years later, during one emergency shift for one govment hospital, “ some group of drunk men pass by me and one of dem even grab me”, Dr Mitra say. “Wen I try to complain, I find di police officers dey doze off wit dia guns for hand.”

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin go happun next and di law
Tins don too spoil for di past years, according to Saraswati Datta Bodhak, one pharmacologist for a govment hospital for India.
"My two daughters na young doctors and dem tell me say hospital campuses for di state dey overrun by anti-social elements, drunk pipo and touts," she say.
Dr Bodhak remember wen e see one man wit gun wey dey waka around one top govment hospital for Kolkata wen e go visit.
India no get strong federal law to protect healthcare workers. Although 25 states get some laws to prevent violence against dem, convictions dey “almost like say e no exist”, RV Asokan, president of di Indian Medical Association (IMA), one organisation of doctors, tok.
One 2015 survey by IMA find say 75% of doctors for India don face some form of violence for work.
“Security for hospitals dey almost absent,” e say. “One reason na say nobody dey think of hospitals as conflict zones.”
Some states like Haryana don deploy private bouncers to increase security for govment hospitals.
For 2022, di federal govment ask di states to deploy security forces wey dem train go sensitive hospitals, install CCTV cameras, set up quick reaction teams, stop any entry to "individuals wey no dey needed" and file complaints against offenders.
But nothing much don happun.










