Wetin to know about di Indian tycoon ogbonge wedding wey Nigerian musician Rema perform for

Anant Ambani and im wife Radhika Merchant during di ceremony for Mumbai

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Anant Ambani and im wife Radhika Merchant during di ceremony for Mumbai

Celebrities from across di world land Mumbai for di wedding ceremony of di youngest son of Asia richest man Mukesh Ambani on Friday.

Anant Ambani, wey be di son of Reliance Industries chairman Mukesh Ambani, marry Radhika Merchant, wey be di daughter of pharma tycoons Viren and Shaila Merchant.

Di four-day ogbonge wedding for Mumbai city na di final stop for di series of lavish party dem wey di family don dey host since March.

Ahead of di ceremony on Friday, heavy rain fall well-well for di city, some parts dey flooded.

Anant papa Mukesh Ambani, wey be 66 years, presently na di10th richest man for di world .

Im net worth na $115bn, according to Forbes. Mukesh papa na im be di founder of di Reliance Industries, im start di business for1966, na very big company wey dey operate for sectors ranging from petroleum and retail, to financial services and telecoms.

Anant na di youngest of Mukesh three children, all of im children dey di board of Reliance Industries. Di 29-year-old dey involved in Reliance energy businesses and im dey di board of Reliance Foundation.

Dis na all you need to know about di ogbonge wedding for India.

When Anant Ambani wedding happun?

Ambani wedding

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Anant Ambani dey marry im long-time girlfriend Radhika Merchant dis weekend

Di couple marry for traditional Hindu ceremony on Friday, 12 July 2024, for di Jio World Convention Centre.

Afta di wedding ceremony, tori be say di family go host ogbonge reception throughout di weekend, before one final reception for dia household staff on Monday.

Key roads for di city dey closed for several hours a day until Monday wey di Party (owambe) go end.

Mumbai police dey label di wedding as "public event" since several international and Indian VIPs dey attend, according to tori pipo Reuters news agency.

Who attend di wedding

Bill Gates and Paula Hurd pose during the pre-wedding celebrations of Anant Ambani

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Bill Gates and Paula Hurd pose during di pre-wedding celebrations for March

From former prime ministers, business moguls, celebrities all bin dey di guest list for di ogbonge wedding.

Reality TV star Kim Kardashian, former UK PM Tony Blair and Nigerian rapper Rema dey among those wey land India financial capital to attend di ceremony.

Mumbai police label di wedding as "public event" since several international and Indian VIPs dey attend, according to tori pipo Reuters news agency.

Rajan Mehra, CEO of air charter company Club One Air, tell Reuters say di family rent three Falcon-2000 jets to ferry wedding guests to di event.

“Di guests dey coming from all ova and each aircraft go make multiple trips across di kontri ,” e tok .

But di restriction don also bring plenty tok-tok – pipo wey dey live for di city complain of traffic, while odas di ogbonge display of wealth for di wedding wey last for months.

Na for March di family begin di wedding festivities, dem hold three-day pre-wedding party for dia home state of Gujarat.

Among di 1,200 guests wey bin attend di celebration na international celebrities, politicians, and members of di business world - including Meta Mark Zuckerberg and Microsoft Bill Gates.

Di party bin start wit performance by Rihanna on di first night. Diljit Dosanjh, di first Punjabi singer to perform for Coachella, climb stage on di second night, while rapper Akon close di show on di final day of celebrations.

Priyanka Chopra and Nick Jonas

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Actor Priyanka Chopra pose outside Mumbai airport wit her husband singer Nick Jonas
Former UK PM Tony Blair and im wife Cherie dey among di political heavyweights for Mumbai

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Former UK PM Tony Blair and im wife Cherie dey among di political heavyweights for Mumbai

How much Ambani wedding cost?

Di Ambanis dey host one lavish wedding, wit celebrations continuing for months and across continents

Wia dis foto come from, Reliance

Wetin we call dis foto, Di Ambanis dey host one lavish wedding, wit celebrations continuing for months and across continents

Di Ambanis neva reveal how much dis wedding go cost dem but wedding planners dey estimate say dem don already spend anywhere between 11bn and 13bn rupees [$132m-$156m].

Tori be say dem pay Rihanna $7m (£5.5m) for her performance, while dem claim say Bieber money fit reach $10m.

Ambani children also do ogbonge pre-wedding festivities. Hillary Clinton and John Kerry bin dey among attendees for Isha Ambani pre-wedding bash for 2018, wey feature performance by Beyoncé. One year later, Akash Ambani pre-wedding bash feature performance by Coldplay.

Fotos of celebs for Ambani wedding

Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Instagram

Justin Bieber

Wia dis foto come from, Instagram

Wetin we call dis foto, Dis week, di final set of celebrations kick off for Mumbai, popstar Justin Bieber perform for di wedding party
Fifa president Gianni Infantino and im wife Leena Al Ashqar pose for pictures on di red carpet

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Fifa president Gianni Infantino and im wife Leena Al Ashqar pose for pictures on di red carpet
Bollywood star and bridesmaid Ananya Panday shos for one tiger-print yellow lehenga wey dem embroid wit"Anant's Brigade" for di back

Wia dis foto come from, Reliance

Wetin we call dis foto, Bollywood star and bridesmaid Ananya Panday shos for one tiger-print yellow lehenga wey dem embroid wit"Anant's Brigade" for di back
WWE legend John Cena joke wit tori pipo as e waka di red carpet

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, WWE legend John Cena joke wit tori pipo as e waka di red carpet
Grammy and Academy award-winning musician A.R. Rahman dey reported to dey part of those wey go perform for di wedding

Wia dis foto come from, Reliance

Wetin we call dis foto, Grammy and Academy award-winning musician A.R. Rahman dey reported to dey part of those wey go perform for di wedding
Indian filmmaker and TV personality Karan Johar wear white kurta

Wia dis foto come from, Reliance

Wetin we call dis foto, Indian filmmaker and TV personality Karan Johar wear white kurta
Nick Jonas and Priyanka Chopra

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Nick Jonas and Priyanka Chopra