Who be Timileyin Ajayi, Salome Adaidu murder suspect?

Salome Adaidu and Timileyin Ajayi

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Facebook, TEASER.T/TIKTOK

Read am in 3 mins

More details dey come out about di suspect Timileyin Ajayi wey allegedly murder im girlfriend Salome Adaidu.

24 year-old Adaidu allegedly die wen she go visit Ajayi for im house for Papalana area wey dey for Karshi for inside Karu local goment area of Nasarawa State, north-central Nigeria.

Authorities arrest Ajayi on 12 January, as im bin dey try to allegedly troway Salome head afta im allegedly kill her and pieces all her body.

Police for Nasarawa State neva charge Ajayi to court for di alleged murder.

Dem parade di suspect on Tuesday 14 January wit knife and machetes wey dem claim say im use to commit di crime.

Tok-tok pesin of Nasarawa State Police Command Ramhan Nansel say once dem conclude dia investigation dem go charge am to court.

Ajayi dey for Nasarawa State Police Command Criminal Investigation Department wia dem keep am until dem finish all di investigation and charge am to court.

Dis na wetin we know about Ajayi:

Who be Timileyin Ajayi?

Timileyin Ajayi wey be gospel singer na 30 years old man from Kogi State, north-central Nigeria.

Ajayi describe imsef as cryptocurrency agent, although im no tok how long im don dey do di business.

Di 30-year-old say im date Adaidu for about one year. Ajayi claim say dia relationship bin dey complicated becos dem no see all di time.

But Adaidu family deny say dia daughter date di suspect.

For im TikTok page, Timileyin describe imsef as cinematographer, content creator, social media manager, videographer and song writer.

'Im cut di body into more dan 50 pieces'

Salome death shock many Nigerians especially her family and friends.

Esther Adaidu, Salome elder sister say: "Dis so-called Timi guy, we no know am. We neva see am bifor until dem call us to tell us say dis guy murder and dismember our sister.

"I demand and need justice to dey served to dis guy wey dey sidon for hia becos na im be di pesin wey murder my sister and im confam am to me."

Samson Adaji Adaidu, Salome uncle say: "...We dey expect justice from di police."

"Im don succeed in destroying our daughter, not ordinary killing, im butcher her into pieces. Im cut di body into more dan 50 pieces and wen you look di whole tin, im dey prepare di body for consumption becos im cut dem and leave dem for about six polythene bags'.

Anibe Treasure Utenwojo wey be Adaidu friend say she bin see di tori for internet and no know say na about her friend until she visit her work place and see say e dey empty.

She say she bin ask Adaidu colleague about am and na di pesin break di news to her.

"Salome Adaidu, your killer no go eva go unpunished and may your gentle soul rest in peace," she write for her Facebook page.

One Nigerian man on Facebook identified as Babyshark001i tok about how she bin meet Adaidu on di social media platform and exchange numbers wit her.

"Now I dey see news about her demise. She don dey allegedly murdered by her boyfriend Ajayi, wey happun to be "gospel singer", Babyshark001i tok.

Bifor she Adaidu die, she bin dey do her youth service for Nicon Insurance Abuja.