'Why many terrorists attack dey happun and how Nigeria fit end am' - Security expert

Image of people carrying guns

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Recently, armed men don dey increase attack for northeast and northwest Nigeria.

Di most recent one na on Sunday 12 January 2025, wia one armed militia group wey be suspected Boko Haram/ISWAP terrorists attack some farmers and fishermen inside Dumba community, near Baga for Kukawa local goment area of Borno State, northeast Nigeria.

For one statement wey commissioner for Information and Internal Security for Borno State, Prof Usman Tar, release, e tok say about 40 farmers na im terrorists kill.

E say dem still dey look for many pipo wey escape di attack to return dem to dia families.

Di Borno State Govnor Prof Babagana Umara Zulum don condemn di attack in strong terms, and call officers and men wey dey for Operation Hadin Kai to catch di terrorist wey dey operate for Dumba and for Lake Chad Area.

Dis na di third deadliest attack in one week wey happun for Borno wey claim so many lives.

For Thursday 9 January 2025, pipo wey dem suspect say be bandits ambush Katsina Community Watch Corps for Baribari town inside Safana local goment area, wey lead to di death of about 20 pipo, according to local source.

Dis one don make many Nigerians dey ask wetin dey happun.

Wetin dis attacks mean and wetin experts dey tok?

Security experts dey see all dis attacks as big threat to Nigerians and national security.

Retired Group Captain Sadiq Garba wey follow BBC News Pidgin tok say di way Boko Haram dey increase attack now dey disappointing sake of e be like say di group wan gain power again.

Di security expert say di problem get connection wit di small number of soldiers wey dey on ground and how politicians and stakeholders no dey monitor military work well.

"E good make Nigerian politicians dey check wetin di military dey do, especially evri month, to know how di work dey go," e tok.

E add say politicians no suppose fear to involve demsef for military mata. If dem fear say dem go get problem wit soldiers, e fit put di kontiri for danger.

"If di politicians dey fear say dem go get wahala wit soldiers, e mean say di kontiri dey for risk," e tok.

E still tok say di small number of soldiers na why Boko Haram fight neva finish afta almost 15 years.

"Di soldiers wey dey on ground for Nigeria too small, and na one of di reason why we dey face all dis problems," e tok.

Di issue no be only di military own, e concern all di stakeholders from di president office to di National Assembly sake of dem no dey monitor di situation well.

Wetin be di solution?

Captain Sadiq believe say Nigeria need to use di money wey dem dey spend for military operations to recruit more soldiers.

E tok say, "Nigeria need more soldiers instead of to dey spend plenty money eviri year for security."

E still suggest say Nigeria suppose involve security experts, especially retired military officers, to advise on how to buy and manage military equipment.

"Di goment need to carry security experts join, especially retired officers wey sabi di work, to help solve di security problem," e tok.

Captain Sadiq say di president office, minister of defence, and lawmakers gatz dey monitor military activities and how dem dey spend money.

"Nigerian leaders suppose dey check how military dey work and wetin dem dey use money do from time to time," e add.