Fans worry over Afrobeats star Asake new look afta YBNL break-up

Wia dis foto come from, Getty Images/Instagram/@asakemusic
Grammy nominated artiste, Asake don enta public tok-tok afta im show im new look for social media recently.
Di 'Lungu Boy' crooner unveil short hair and and face tattoos as im dey release wetin be like short video to announce im new projects wey include Why Love and Bad Boy.
Pipo don rant all ova social media on top di move for im look most especially wit im face tattoos.
Some pipo don tok say di tattoos no fine for im face and odas say e fit live to regret di decision as odas still dey fear for im mental heath.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4
Di Sungba singer, wey im real name na Ahmed Ololade dey very well known for im fashion sense wey include im giant trousers and skin tight tops.
All dis dey happun afta tori drop say di singer bin comot im record label, YBNL late last year as e comot evritin wey get to do wit di record label from im Instagram page.
Even wit all dat tori, di distribution partner of YBNL, EMPIRE still get im latest album, Lungu Boy wey im drop for August for dia website.
Asake bin just drop di music video from im Lungu album as e bin dey make dis announcement.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Asake don get different era of how e don look from im hairstyle since im bin blow up for 2020 afta di release of im hit single Mr Money.
E don go from fat dreads to longer braids and even do tinted hair at some point in im career.
So far, Asake don run three albums wit YBNL for im career, wey dem call Mr Money With The Vibe, Work of Art and Lungu Boy.
Im first album Mr Money With The Vibe bin break record for di Billboard 200 chart as di highest charting Nigerian debut album wey di chart don get at dat time.
For 2023, e win di Next rated award for di Headies in September.
Asake describe how im join di label for different interviews say, "na Yhemoleee show Olamide wetin I fit do na so Olamide call me one day say make we see and wen we finally meet, wit out any paparazzi, e ask me weda I wan join YBNL, sometin wey I don dey wait for years".
For 2022, e sell out O2 Arena for concerts wey last three days sotay two pipo lose dia life for December on to stampede to try enta im show.
So far e don get two nominations for di Grammy awards. For 2024, e bin dey nominated for Best African Music Performance for im song Amapiano.
E also dey nominated for di 2025 Grammys of di same category for di song MMS wey im do wit fellow musician, Wizkid.