Wetin dey happun for Lagos State House of Assembly

Wia dis foto come from, Mojisola Meranda/Obasa/X
Members of di Lagos state house of Assembly for Nigeria, neva still recover from di invasion of federal security forces wey bin storm, plus to take over di legislative premises early on Monday.
Heavy security surround di Lagos State House of Assembly, as lawmakers gather to sit on Monday
Officials of di Department of State Services (DSS), Nigeria Police Force, and Lagos State Task Force bin block di front of di assembly complex to provide security for any external interference.
Di security officials no allow lawmakers access into parliament ahead of di expected resumption of plenary of di former Speaker, Mudashiru Obasa tomorrow.
Dem bin also block di new Speaker of di Lagos State Assembly, Mojisola Meranda, from entering her office for one hour.
Inside one viral video for social media, di blockade cause serious tension as lawmakers and staff of di assembly gada demsef, storm di chamber to show solidarity.
Later, di lawmakers bin dey forced to do dia plenary for di garden in front of di Chamber.
Di members express dia shock over di invasion wen dem gada for plenary.
During plenary, di lawmakers call on di Director General, Department of State Security Services, Di Nigeria President Bola Tinubu and Members of di National Assembly, make dem torchlight di undemocratic incident.
Commenting on di mata as Kehinde Joseph wey dey represent Alimosho constituency two raise am, members condemn di invasion of di parliament wey dem call 'assault on democracy. '
Di lawmakers argue say, di way di security agents take do di invasion na embarrassment to democracy, come add say anybody wey bin get agro wit new leadership of di House, make e go solve di mata for court.
Anoda videos online show as di speaker finally enta di building wit some security officials protecting di building.
Lagos lawmakers say dem remove Chief Obasa becos dem don tire wit im high handedness, intimidation and servitude.
Dis dey happun days afta di removal of former speaker Mudashiru Obasa, wey dem comot from office wen e travel abroad.
Obasa don file lawsuit for di Lagos State High Court against di house assembly to challenge im impeachment from office.
Earlier, acting Clerk of di House, Taiwo Oshun read one letter from di State High Court wey inform di lawmakers of one court case wit di former Speaker, Mudashiru Obasa.
All di thirty-six lawmakers wey follow attend di plenary for garden, pass vote of confidence on di new Speaker, Mojisola Meranda.
Di House don adjourn di sitting indefinitely.










