Nigeria goment give details about first batch of deportees from US wey dem dey expect

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Nigeria goment bin announce say di first batch of Nigerians wey di US goment don deport, dey expected to arrive di kontri on Monday, 17 February 2025, however dis batch still dey awaited as at dis Tuesday morning.
BBC Pidgin dey monitor dis story closely.
Di Minister of State for Foreign Affairs, Bianca Odumegwu Ojukwu, for one post on social media on Monday tok say she meet wit di United States Ambassador to Nigeria, Richard Mills Jr, and she highlight di concern of di Nigeria goment about di decision of President Donald Trump to deport many Nigerians back to di kontri.
"As at now, na about 201 Nigerians currently dey detained for US immigration centres, and about 85 (of dem don dey) cleared for deportation. Di figure dey expected to rise sharply," Madam Ojukwu tok.

Wia dis foto come from, Bianca Odumegwu Ojukwu/Facebook
For her discussion wit di US ambassador, Ojukwu tok say she maintain say "dis deportations, particularly for individuals wey no get history of violent crime, no suppose dey traumatic or sudden and say di individuals need to dey given enough time to handle dia assets rather dan say dem go just bundle dem enta planes and repatriate dem".
"Di forced removals of our citizens from US soil must dey in compliance wit internationally prescribed guidelines and established protocols in dis regard and a more humane process supposed dey followed," Ojukwu tok.
She tok say di ambassador give am im word say "di repatriations go dey done wit dignity and respect for human rights".
At least, ova 3,000 Nigerians wey no get legal documents to stay for America dey face risk of deportation, according to one document wey Fox News get from di United States Immigration and Customs Enforcement and Removal Operations (ICE).
Fox News bin report on Tuesday 28 January, 2025 say di Nigerian immigrants don dey ICE non-detained docket wit final orders of removal since November, 2024.
Reports say Nigeria na di second highest number of citizens wey dey scheduled for deportation for Africa, followed by Somalia, Ghana, Senegal, among odas.
For im 2024 campaign President Donald Trump bin promise to deport one million pipo wey no get legal permission to dey live for di United States.
BBC Pidgin bin don report how plenty African immigrant communities for America dey for panic as dem dey fear raid, detention and deportation. Many of dem sef don go underground.
Immigrants tell BBC say na inside house dem dey stay now, dem dey skip work, reduce dia presence for public functions and no dey allow dia children go school sake of fear say officers from Immigration and Customs Enforcement (ICE) fit detain dem.
"I dey caution my waka and get faith in Allah say evri tin go dey alright," Abdul from Nigeria wey dey live for Wisconsin tell our tori pesin for dat report.
Abdul bin go America wit im papa about 30 years ago, wen e dey 10 years old.
E say fear dey catch am as e dey hear and watch how ICE officials dey carry out dia operations for oda cities.
"E dey crazy how dem dey treat pipo, like say we no be pesin too. All of us be humans, and all of us dey bleed di same way," e tok.










