Five tins ‘impeached’ speaker Mudashiru Obasa tok for im press conference wey cause reactions

Wia dis foto come from, LSHA
Di former speaker of Lagos state house of assembly Mudashiru Obasa don speak for di first time since im impeachment.
Obasa tok for press conference wia e address several issues like im status for di house, allegation of corruption, governorship ambition for im house for GRA area of Ikeja.
Dis dey come few weeks afta im impeachment on Monday, 13 January for di assembly chambers.
Dat day, 90% of members of di house vote to comot am sake of alleged misappropriation of funds and abuse of office.
Di lawmakers replace Obasa wit Mojisola Meranda.
During di five minute plus press conference, di former speaker bin look relaxed, im wear Maroon polo t-shirt and black face cap as im tok im mind and answer kwesions from tori pipo.
Dis na di five tins im torchlight for di press conference.
Corruption allegations
Di press conference start wit di corruption allegations wia Obasa say ''pesin wey allege must do wetin?“ Obasa ask.
We get document to support all di expenses wey we don incur for Lagos state house of assembly.
And if any oda pesin get a different view, make dem bring dia own document so we go compare document to document, simple.
Kwesion about im govnorship ambition
Obasa answer kwesion about im ambition to be governor of Lagos state.
''To get ambition to become govnor no be sin, na sin? Obasa ask. However I tok am for di floor of di house during di presentation of di budget''. Im explain
I tok say I no get any thought of govnorship but e no mean say one, I no qualify or I lack experience and I still maintain dat position.
But for di whole of Lagos state make any leader, anybody come out to explain say Obasa approach am to say I wan be govnor. Na simple tin.
Impeachment
Obasa reveal wetin bin dey go through im mind wen im hear about im impeachment.
For my mind, no be Obasa title, speaker dey like general wey go war, you fit come back or you fit no come back.
As you see me like dis I dey lively, I dey kotinu to enjoy myself, e no disturb me and e no dey worry me.
But to remove you must follow due process as I bin tok. We get rules, we get constitution.
Wen you wan remove you must follow due process. At di same time dat man wey tok say Obasa bin take part for di removal of honourable Abdulahi Pelumi, honourable Fuumi Tejusho and those pipo wey chop suspension I don tok am bifor make I repeat am again.
Honourable Pelumi na my broad na my friend, I dey call am broda Waheed. Wen dem remove am, im bin dey for di floor of di house probably im bin dey lead.
Wen dem comot Tejusho she bin dey inside di house and those wey chop suspension dem bin dey around and dem no involve police.
Nobody break enta di chambers and dem no bring fake maze enta di house.
I no dey fear make dem remove me oh! If you be member of di house for 20 something and you be speaker for almost 10 years me e no dey disturb me oh. But make dem follow di true procedure and make we close am.
Tori be say Obasa no bin dey present wen lawmakers sit dat Monday as tori be say im bin dey travel out of di kontri.
Relationship wit President Tinubu
Obasa call President Bola Tinubu im 'brother' but no really give details about dia relationship.
But im tok about im relationship wit lawmakers and di Govnor Babajide Sanwo-Olu.
All of dem na my brothers and sisters, I dey always tok am. You suppose know.
Di way I dey refer to dem as my brothers, my sisters, my colleagues dey so loyal so dedicated. But for me I be who I be.
Nothing don go wrong and nothing don change.
And to our Govnor, I dey hail am and I thank am for wetin im dey do.
To our GAC, GAC mean Governance advisory council, dem be our leaders, dem be our fathers we appreciate dem.
‘I still be di speaker of Lagos Assembly’
Di last kwesion wey Obasa answer na di kwesion about im status for di house.
I believe strongly say I still be di speaker, I still be di speaker until dem do di right tin.
If you wan remove me, remove me di proper way, I no go drag am. Make we do tins di way wey e suppose be.
Dem ask am if e go carry di mata go court, im say: You go know, na mata of time.
Who be Mudashiru Obasa - Former Lagos Assembly Speaker

Wia dis foto come from, Mudashiru Obasa/X
Mudashiru Obasa na Nigerian lawyer and politician wey don serve as Speaker of di Lagos State House of Assembly since 2015.
Dem born am for Agege, one town for Lagos state, south-west Nigeria on 11 November, 1972.
For 1999, e contest for di seat of councillor for Agege local goment under di Alliance for Democracy Party and e win. E serve between 1999 and 2002.
Dem elect am to di Lagos state house of assembly for 2003 to represent Agege constituency 1.
E serve for plenty committees wey include Committee on Lands and Housing and Physical Planning. For different times, e don serve as Chairman of Committee on Rural Development, House Committee on Public Account for Local Government for six years and Chairman, House Committee on Budget and Economic Planning.
Dem re-elect Obasa for 2011, 2015, 2019 and for 2023.










