EFCC drag Malami, im wife and son go court again as new judge cancel former bail

Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) drag di former Attorney-General of di Federation (AGF), Abubakar Malami (SAN), im wife, Asabe Bashir, and son, Abdulaziz go court again sake of money laundering offence.
EFCC drag dem go di Federal High Court for Abuja, sake of say dem assign di case to new judge wey go handle di trial.
Justice Joyce Abdulmalik wey resume hearing of di mata for di Federal High Court, sama Malami and di oda defendants ₦200 million naira bail condition as she cancel di former bail condition wey dem bin don meet under di former judge.
Justice Abdulmalik say as di mata dey start afresh for her hand, evri oda tin wey dem don do before go also start afresh.
If Malami meet di bail conditions im go go house but if im no meet am im go dey for Kuje prison.
For Abuja on Friday, di EFCC lawyer, Jibrin Okutepa, SAN, tell court say dem schedule di mata to re-arraign Malami, im wife and son.
"Di mata dey come before your lordship dis morning for di veri first time. I go apply make di defendants take dia plea" im tok.
Okutepa also apply make dem correct di money wey dey for Counts 11 and 12. E say e suppose be ₦325 million instead of ₦325 billion for Count 11, and ₦120 million instead of ₦120 billion for Count 12.
End of Di one wey oda users dey read well well
Justice Abdulmalik grant di oral application becos di defence lawyer Joseph Dauda (SAN) no argue.
Di defendants, plead not guilty to di 16 counts charges wey EFCC sama dem.
Who be di judges wey don handle dis case so far
Malami, im wife and son dey get new judge wey go hear dia case for di third time now.
Na on February 12 wey Justice Obiora Egwuatu bin withdraw from di case afta EFCC drag di defendants go court.
Oga Malami, im wife, and son bin face Justice Nwite on December 30, 2025.
Justice Emeka Nwite na di second judge wey bin dey handle di case wey bin sit as vacation judge during di Christmas/New Year break.
Afta di festive period pass, dem bin reassign di cases to Justice Obiora Egwuatu, wey comot imsef from di case, before dem kon reassign am to Justice Joyce Abdulmalik.
Court bin order Malami to stay for Kuje Correctional Centre, im wife Asabe bin land for Suleja Correctional Centre.
Na ₦500 million naira bail each court bin sama dem on January 7. Court also say dem go bring two sureties each.
How dis mata start
Na Malami first break di tori say di EFCC dey investigate am on top mata wey concern di recovery of money wey former Head of State Sani Abacha bin tiff hide for Switzerland.
Di amount wey dey involve na about $346.2 million.
Malami tok say EFCC dey accuse am of among oda tins wuruwuru on how im involve some law firms and pay dem plenty moni to help wit di legal processes of returning di money, wen e know say di former administration don already almost finish all di processes wey dey involved.
Den, e get di mata of terrorism financing wey Malami also take im hand post for im social media wia e deny say im hand no dey for anytin like dat.
"I state clearly and unequivocally say I neva dey accused, invited, interrogated, investigated or charged by any security, law-enforcement, regulatory or intelligence agency—within or outside Nigeria—in respect of terrorism financing or any related offence," Malami tok for dat statement wey e post for im Facebook page on 5 December.
Abubakar Chika Malami serve as di Attorney General of di Federation and Minister of Justice for eight years under President Muhammadu Buhari.
Di Senior Advocate of Nigeria come from Kaduna State, dem born am for 1967 and e study law for Usman Dan Fodio University for Sokoto State, for di northwest region of Nigeria.
Dem call Malami to di Nigeria Bar in 1992 and e rise to di rank of SAN in 2008.
Malami bin run for di guvnorship position for Kebbi State for 2014 under di All Progressives Congress (APC), but e lose, and shortly afta, President Buhari appoint am as di AGF.
Even during im time for govment, Malami don face plenty accuse of wrongdoing, some of di accuse dem investigate and clear am while odas, no too get any action on top am.













