Beating of Rivers LGA Sole administrator - more details come out afta police intervention

Rivers Police Commissioner Olugbenga Adepoju and di Sole Administrator of Ahaoda East LGA Goodluck Iheanachor

Wia dis foto come from, Olugbenga Adepoju/Goodluck Iheanachor/Rivers Police

Read am in 5 mins

Rivers state police don condemn di attack on di sole administrator of Ahoada-East Local goment area, Goodluck Iheanachor and invite im chief of staff to come answer kwesion on di matter.

Police claim say Hector Ekakita, wey be di chief security officer and di Chief of staff to di sole administrator allegedly storm di council secretariat wit 30 jaguda pipo, wey attack oga Iheanacho.

Di attack happun on Friday 20 June for di council secretariat according to police.

During di attack, di jaguda pipo beat di Sole Administrator, tiff im mobile phones, force am to sign im letter of resignation, den go away vital documents, including official and personal documents from im office, police tok.

Dis incident dey happun few months afta Rivers State Sole Adminstrator Vice Admiral Ibot-Ete Ibas bin appoint 23 sole administrator few months ago for all di local goment area ,to torchlight dia activities afta im appointment.

Dia work na to perform di functions wey normally di elected officials go do, dia work include managing di council administration, finances, and personnel, as well as representing di LGA in various matters.

Police say Iheanacho dey hospital wia im dey currently collect medical treatment sake of di injuries wey e get during di violent attack. Im dey stable condition.

Meanwhile di commissioner of Police, Olugbenga Adepoju, visit di scene of attack wit heads of oda sister security agency for di state and vow to take action.

Wetin dey di viral video

For di viral video, Honourable Iheanacho wear grey native sitdom for ground, surrounded by di Jagudu pipo.

Di 1:25s clip wey BBC no fit verify show as di jaguda pipo flog di sole administrator of Ahoada-East Local goment area and shout on am to sign di document wey dem give am.

Di Jaguda pipo later tie im hands and call one guy wey im name na Sir Charles to confam di signature.

Afta dem tie di Sole Administrator hand anoda man wey wear black jeans and green t-shirt enta di room.

One of di boy shout ''who be dis one'' bifor dem tem am to lie down and begin to flog am too.

'I only see pipo wey enta im office'

Di chief security officer and di Chief of staff to di sole administrator of Ahoada-East Local goment area don deny say im carry jaguda pipo to visit and attack dia Oga, Goodluck Iheanacho.

For one voice note Hector Ekakita deny di accuse and explain wetin happun.

According to Oga Ekakita, e say ''na di youth of di local goment wey visit am to try to find out why Im no gree take care of di council, wey include sanitation, paying off of security and political appointees.

''As CSO I only see pipo wey enta im office and come out, so anybody wey dey mention my name, I bin no dey di scene of di crime and I no mobilize anybody''.

''If di youths come to ask am wetin im bin dey do wit di simplified pipo to di extent of carrying CV of one Fabian Braide wey im bin lodge for Meb hotel for 2-3 days to employ am to di council''.

''Di youth approach am to ask am wetin dey happun and me I no know wetin happun dia between him and di youth''.

''Only for me to hear say im don sign for im resignation, I no get hand inside di mata na him know di pipo im dey call jaguda pipo''.

''Anybody don hear of killing, shooting or kidnapping since I assume office'' di CSO ask?

''So na him know wetin im tell di youth wey dem begin exchange words''.

''Anything wey happun dia I no dey dia, so make im tell police di truth''.

''Di pipo wey visit am na youths from di LGA no be thugs''

Rivers state emergency rule

Na March 18, 2025, President Bola Tinubu declare state of emergency for Rivers state and suspend di governor, im deputy and all lawmakers for di state parliament for six months.

For one nationwide broadcast on Tuesday evening Tinubu say im receive "disturbing security reports wia im detail incidents of vandalization of pipelines by some militants without di govnor taking any action to curtail them".

Im add say im no allow di "grave situation" to kotinu.

But lawyers and opposition politicians dey kwesion di legality of di president decision.

Tinubu bin make di announcement afta one of di kontri highest producing crude oil pipelines, di Trans-Niger Pipeline, bin suffer significant damage sake of blast.

In di past criminal gang or militant don carry out attack on pipelines wey, halt production and exports.

At current prices, the oil flowing through the affected pipeline fetches around $14m (£11m) a day, according to the online publication Africa Report.

But against the backdrop of the blast, there has been a political rift in Rivers state that has reached boiling point.

Govnor Siminalayi Fubara na member of di People Democratic Party wey dey face serious wahala.

PDP na di main opposition party to di president's All Progressives Congress.

Tinubu say politicians no bin fit work togeda effectively sake of di wahala. Im allege say Fubara allies bin threaten "fire and brimstone" against di govnor enemies and dem no "disown" dis comments.

Rivers state lawmakers bin threaten to impeach di govnor and im deputy.

Tinubu say dis political crisis don leave Rivers state im "standstill" im add say dis im move dey based on di need to restore peace and order for di state.

Fubara react to di state of emergency, im say na "political disagreements, but good governance dey kotinu".

"Rivers state dey safe, secure and peaceful under our watch," im tok.

Di state of emergency allow di goment to run di state in di interim and dem go send security forces if need dey.