'I no see anytin, I no do anytin wrong,' Bill Clinton tok as e testify about Jeffrey Epstein

Wia dis foto come from, Eugene Gologursky/Getty Images for The New York Times/ @BillClinton/X
Former President of United States of America Bill Clinton on Friday say im no see anything and "I no do nothing wrong" for im opening statement to US lawmakers about im relationship with sex offender Jeffrey Epstein.
Di House Oversight Committee issue subpoena for Bill Clinton and im wife Hillary as dem demand dia testimony and threaten to hold dem for contempt of Congress if dem no comply.
Bill Clinton meet wit di committee behind close doors to tok about im connection to Jeffrey Epstein for Chappaqua inside New York on Friday.
Inside di statement wey di ex-president post on X on Friday, e tok say im no get any idea of di late sex offender crimes and no mata wetin dem dey show am, di 20-year-old fotos, im know wetin im do and wetin im no do.
"No mata how many photos you show me, I get two tins wey dey matter more dan your interpretation of di 20-year-old fotos. I sabi wetin I see, and more importantly, wetin I no see," e tok.
"I sabi wetin I do, and more importantly, wetin I no do. I no see anything, and I no do anything wrong."
Clinton tok say as pesin wey grow up for home wia domestic abuse bin hapun, no be only say im no go gree to fly wit Epstein, im go also lead di call for justices for im crimes if to say e know anything.
"As pesin wey grow for house wit domestic abuse, no be only say I no go gree to fly for im plane if I get any idea of wetin e dey do — I go report am myself and lead di call for justice for im crimes, no sweethearts deals," Clinton tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"But even wit 20/20 hindsight, I no see anytin wey make me pause," e tok.
Clinton tok say im wan meet wit di committe becos Jeffrey Epstein hide im crimes from everybody for a long time.
E tok say im don already disassociate im sef wit Epstein by di time di public know di truth and Epstein don plead guilty to im crimes for 2008.
"You go hear me say I no remember. E fit dey unsatisfactory. But I no go tok wetin I no sure of. Dis one don hapun long time ago. And I dey bound by my oath make I no guess," Clinton tok.
"E no go help you if I dey play detective 24 years later. Since I dey under oath, I no go falsely say I dey look forward to your questions. But I dey ready to answer dem to di best of my abilities."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Inside di statement wey Bill Clinton prepare for di committe, e tell di commitee say im wife, former Secretary of State Hillary Clinton, no get any memory of meeting Jeffrey Epstein and dem no suppose invite her.
On Thursday, Hillary bin meet wit di committee behind close doors for six hours, she tell di panel say, " she no get any idea" about Jeffrey Epstein crimes.
She ask di lawmakers make dem question President Donald Trump under oath about im past connection wit di late sex offender while she deny wrongdoing in relation to Epstein.
Di former president tell di committee wey force him wife, former Secretary of State Hillary Clinton, to testify about di last sex offender say:
"Before we start, I need to get personal. You make Hillary come. She no get anything to do wit Jeffrey Epstein. Nothing. She no even remember meeting am," di former president tok.
"She no travel wit am or visit any of im properties. Weda you subpoena 10 pipo or 10,000, including her, e no just dey right."
Meanwhile, di committee tok say dem go release di video of Hillary Clinton testimony for di public.
"We go try make sure say we fit release di video today, or later tomorrow," James Comer, di Republican chairman of di House Oversight Committee tok.
Di House Oversight Committee don ask for testimony from President Donald Trump about Epstein.
Epstein and Trump dem be friends for many years bifor dem fall out for early 2000s.
Authorities arrest Epstein in July 2019 for federal child sex trafficking charges, during Trump first presidential administration.
Epstein kill imself weeks later for federal jail for New York City.
Inside one interview, Trump tok say millions of documents wey dey related to Epstein wey di Department of Justice recently release don clear am from any wrongdoing.
Bifor now, Trump no gree make Congress release di files, but e later agree to sign am into law for November.











