New fotos from Epstein estate show Trump, Andrew and Bill Clinton

Wia dis foto come from, Alex Wong/Getty Images, Max Mumby/Indigo/Getty Images, Tom Brenner/Getty Images
- Author, Brandon Drenon
- Read am in 7 mins
Democratic US lawmakers don release two new batches of fotos from Jeffrey Epstein estate, wey dey show details of di convicted paedophile home and ties to di rich and powerful.
US President Donald Trump, former prince Andrew Mountbatten-Windsor and former Trump adviser Steve Bannon dey among di ogbonge pipo wey feature in side di fotos. Di images, many of which pipo don see bifor, no dey imply wrongdoing.
Di nearly 100 fotos wey di House Oversight Committee release on Friday na some of more dan 95,000 images obtained via subpoena, di Democrats tok.
Di justice department dey separately approach one deadline next week to publish all documents wey dey related to Epstein.

Wia dis foto come from, House Oversight Committee
For di first batch of fotos wey di lawmakers release on Friday, you go see Epstein wit plenti ogbonge pipo; none of dem comment on top dis mata yet. Many of dem also previously deny any wrongdoing in relation to Epstein.
Trump dey inside three of di images dem release on Friday. Inside one foto, im dey stand next to one woman wey dem don cova her face.
For anoda foto, you go see Trump dey stand next to Epstein while im dey tok to model Ingrid Seynhaeve for di 1997 Victoria's Secret party for New York – dat image also already dey public.
Inside di third foto Trump dey smile wit plenti women, wey dem cova dia faces , for im left and right side.
Anoda foto dey show illustrated likeness of di president on red packets next to one sign wey get di writing: "Trump Condom".
Di White house don describe di release as "Democrat hoax" against Trump "wey dem don deny many times". Trump for months argue say di Epstein saga na distraction wey im critics do, to swerve di mind of pipo away from tins im administration don accomplish.

Wia dis foto come from, House Oversight Committee

Wia dis foto come from, House Oversight Committee
Di Friday files include private fotos of Epstein, wey include one of am inside bathtub and anoda one wey bin dey show sexual toys. E also dey show am wit many oda ogbonge pipo wey include former President Bill Clinton and tech billionaire Bill Gates.
One foto show Clinton dey stand near Epstein and Ghislaine Maxwell, wey dem convict for 2021 for her role in facilitating di disgraced financier abuse.
Two oda pipo wey di BBC neva identify also dey inside di picture, wey dey look like Clinton don sign am.
Clinton don also deny any wrongdoing for dis mata about Epstein.
For 2019, one tok-tok pesin explain say e "neva know anytin about di terrible crimes" wey Epstein plead guilty to.
One oda foto wey dey included in di Friday batch na one picture wey dem crop some part - wey one photographer wey dey work wit Getty images originally take for 2018 - show King Charles wey dey chat wit Microsoft founder Gates for one London summit.
Di foto inside di Epstein collection dey cropped to show only Andrew and Gates.
Dem strip Andrew of im "prince" title; wey Andrew don face years of scrutiny ova im past relationship wit Epstein.
Andrew comot im mansion for Windsor, Royal Lodge early dis year. E don deny any wrongdoing.

Wia dis foto come from, House Oversight Committee

Wia dis foto come from, Getty Images
Former Trump adviser Steve Bannon also dey inside some of di images. Inside one, dem show am say e dey speak wit Epstein for di side of one desk, wey for anoda, im dey stand beside am in front of one mirror.
Di third image dey show say im dey tok wit filmmaker Woody Allen.
Oda ogbonge pipo wey appear inside di images dey include US economist Larry Summers, lawyer Alan Dershowitz and entrepreneur Richard Branson.
No be all di images dey show dose pipo wit Epstein.
Dem no add any more context or details, so e no dey clear wen, why or wia dem take many of di fotos or who take dem, including images from wetin dey look like Epstein im estate for di US Virgin Islands, wey show multiple rooms - including one wit dental chair wey dey surrounded by sculptures of moustached men on di walls, a scene wey feature inside one past release of Epstein files.
Anoda foto dey of one orange pumpkin wit blonde wig wey dem carve just like Trump.
On top of it, dem write: "Trumpkin. Make Halloween Great Again."

Wia dis foto come from, House Oversight Committee
Republicans, wey be di majority on di House Oversight Committee, don accuse Democrats of "cherry-picking fotos and making targeted redactions to create false narrative about President Trump".
Inside dia statement, Representative Robert Garcia, di top Democrat on di congressional committee, tok: "Time don reach to end dis White House cover-up and bring justice to di survivors of Jeffrey Epstein and im powerful friends."
"Dis disturbing fotos dey raise even more questions about Epstein and im relationships wit some of di most powerful men for di world. We neva go rest until say di American pipo get di truth. Di Department of Justice gatz release all di files, NOW," e tok.

Wia dis foto come from, House Oversight Committee
Epstein im connection to multiple ogbonge pipo, along wit various unanswered questions about di case, and im 2019 suicide for jail for Manhattan as e bin dey wait di trial on sex trafficking charges, don spark online conspiracies and demands for greater transparency around di investigations into di billionaire financier.
Afta months of pressure from across di political spectrum, di justice department get until 19 December to release all documents wey dey relate to di Epstein case as required by one bill dem pass nearly unanimously by Congress wey Trump don sign for November.
Dat deadline wey dey come up, dey separate from di congressional investigation into di Epstein case.
Di Friday publication be di second time in one month wey Democrats on di committee don publish new images from dia inquiry into Epstein.
Dem originally release 19 images on Friday morning bifor dem publish anoda 80 later in di day, saying inside dia statement: "In di interest of transparency, we gatz continue to release fotos from di Epstein estate".

Wia dis foto come from, House Oversight Committee
Dem ask Trump about di new fotos on Friday evening wey e tok reporters say many pipo sabi wen dem capture dem wit Epstein; e describe di release as "no big deal".
Trump and Epstein be friends for di 1990s, but according to di president, dia friendship scata for di early 2000s, two years bifor dem first arrest Epstein. Di White House also previously tok say Trump don boot am out from im Florida resort for "being a creep".











