Which pipo dey inside di Epstein list wey just drop?

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Jaroslav Lukiv
- Author, Olivia Davies
- Author, Chi Chi Izundu
- Role, investigations correspondent
- Read am in 4 mins
Billionaire Elon Musk and Prince Andrew na di names wey don drop for for new files wey Congressional Democrats drop wey get linked to di late convicted sex offender Jeffrey Epstein.
Na di Jeffrey Epstein Estate carri di files give di House Oversight Committee and e be like say Musk bin dey invited to Epstein Island for December 2014.
Apart from am, one manifest from one flight from New Jersey to Florida for May 2000 say di Duke of York bin dey part of di passengers.
We don reach out to Musk and Prince Andrew for comments.
Prince Andrew don refuse sam-sam say e do anytin wrong. Musk don previously quoted say e tok say Epstein bin invite am to go di island but e no gree go.
Dis partial records na from di third batch of documents wey Epstein estate don bring come out. Democrats for di House Oversight Committee say dem include phone message logs, copies of flight logs and manifests for aircraft, copies of financial ledgers and di daily schedule of Epstein.
Di files wey dem release give di public also get popular pipo like internet businessman Peter Thiel and Steve Bannon wey be former adviser to US President Donald Trump.
One line for di records from 6 December 2014 tok say, "Reminder: Elon Musk to island Dec. 6 (Dis still dey happun?)"
Flight manifest records show say Prince Andrew bin dey flight wit Epstein and im associate Ghislan Mawell from Teterboro, New Jersey, to West Palm Beach, Florida, on 12 May 2000. Dem convict Maxwell for 2021 say she collabo wit Epstein to traffic girls for sex.
One ledger wey dem comot plenti tins inside show two records of payments for massages for one "Andrew" for February and May 2000.
Even though Palace records, pictures and press reports from dat time show say Prince Andrew bin travel enta US around di dates wey dem record for di newly released document, e no clear who be di "Andrew" wey di ledger dey tok about.
For 11 May 2000, Buckingham Palace tok for im website say Prince Andrew bin go New York to attend one reception for di National Society for di Prevention of Cruelty to pikin dem. Andrew go back to di UK for 15, according to anoda website entry.

Wia dis foto come from, EPA
One entry also dey di files wey tok about planned lunch wit Peter Theil for November 2017.
Anoda entry na about planned breakfast wit Steve Bannon 17 February, 2019.
Di files also mention plans wey bin no solid for breakfast party wit Microsoft founder, Bill Gates for December 2014. For 2022, Gates bin tell di BBC say meeting Epstein na "mistake".
E no dey suggested say di pipo dem mention for di files bin know about di alleged criminal activity wey dem go later arrest Epstein for.
Epstein bin die by suicide for New York jail for August 2019 as e bin dey wait trial for sex trafficking charges.
For 2008, e reach plea deal wit prosecutors afta di parents of one 14 year old girl tell police for Florida say Epstein bin molest dia daughter for im Pal Beach house.
Dem arrest am again for July 2019 for sex trafficking charges.
Tok-tok woman for di Democrats for di House Oversight Committee Sara Guerrero tell US Attorney General Pam Bondi to release more files wey dey linked to Epstein.
She say "e suppose dey clear to evri American wey Jeffrey Epstein bin dey friends wit some of di most powerful and richest men for di world.
"Evri new document wey come dey give new informate as we dey work to bring justice for di survivors and victims."
Republicans for di committee accuse di Democrats say dem "put politics ova victims" and tok say dem go soon drop di full set of documents.










