Wetin we know about new Epstein emails wey mention Trump

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Nadine Yousif
- Read am in 7 mins
US lawmakers don release more dan 20,000 pages of documents from di estate of di disgraced financier and convicted sex offender Jeffrey Epstein, including some wey mention President Donald Trump.
Early on Wednesday, Democrats for di House Oversight Committee bin publish three email exchanges, including correspondence between Epstein, wey bin die for 2019 inside prison, and im long-time associate Ghislaine Maxwell, wey dey currently serve 20-year prison sentence for sex trafficking.
Dem also release emails between Epstein and di author Michael Wolff, wey bin don write plenti books about Trump.
Within hours, House Republicans bin release plenty documents to counter wetin dem say na Democratic effort to "cherry-pick" documents. Dem also say na attempt to "create fake narrative to slander President Trump".
White House Press Secretary Karoline Leavitt say House Democrats bin "selectively leak" di emails to "liberal media to create fake narrative to smear President Trump".
"Di fact remain say President Trump kick Jeffrey Epstein out of im club decades ago becos im dey make slow and noiseless move towards im female employees, including Giuffre," she tok.
Trump na Epstein friend for many years, but di president don tok say dem bin get issue for di early 2000s, two years bifor police first arrest Epstein. Trump bin don consistently deny any wrongdoing wey relate to Epstein.
Wetin di Epstein-Maxwell email tok
Di first email wey di Democrats bin release na from 2011 and na between Epstein and Maxwell.
inside di email, Epstein write to Maxwell: "I want make you realise say di dog wey neva bark na Trump.. [VICTIM] bin spend hours for my house wit am".
Epstein continue to write say Trump "neva for once don dey mentioned", including by any "police chief".
Maxwell bin respond: "I bin dey tink about am..."
Dem edit di victim name comot from di email wey di Democrats release, although di unedited version dey for di part wey di committee bin release. Wey show di name "Virginia".
Di White House say e refer to di late Virginia Giuffre, one ogbonge Epstein accuser wey bin die by suicide early dis year.
For statement, di White House bin say Giuffre "bin repeatedly say President Trump no dey involved for any wrongdoing whatsoever and 'im for no fit dey too friendly' to her for dia third limited interactions".
Giuffre bin tok for 2016 say bin no eva see Trump participate for any abuse. And inside one memoir wey dem bin release dis year, she no accuse di president of any wrongdoing.
Wen dem bin ask why dem originally edit di name comot, Representative Robert Garcia - di leading Democrat for di US House Oversight Committee - bin say di party no go eva release names of victims in line wit di wishes of di families.
![Image show email exchange wey dey released as part of di files, wit one highlighted line wey say: "dat dog wey never bark na Trump.. [VICTIM] spend hours for my house wit am".](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/cf24/live/bae649c0-c001-11f0-8456-eff94716b162.jpg.webp)
Wetin di Epstein-Wolff emails tok
For di exchanges wit Wolff, di author, Epstein discuss im connection to Trump, wey- for dat time - bin dey campaign for di presidency ahead of im first term in office.
For di second email exchange wey di Democrats bin release, Wolff write to Epstein for 2015 to notify am say CNN dey plan to ask Trump about dia relationship, "either on air or informal manner afterwards".
Epstein respond: "If we go fit craft an answer for am, wetin you tink say e suppose be?"
Wolff write: "I tink say make you let am hang imself. If e say e neva enta di plane or di house, den dat one go give you solid PR and political currency. You fit hang am in a way wey fit generate positive benefit for you, or, if e really look like say e fit win, you fit save am, to generate debt."
E add: "Of course, e dey possible say, wen dem ask, im go say Jeffrey na great guy and im don get raw deal and e be victim of political correctness, wey go dey outlawed for Trump regime."

Wia dis foto come from, Reuters
For separate email from October 2016, days before di US presidential election, Wolff give Epstein chance to sit for one interview wey fit "finish" Trump.
"Opportunity dey to come forward dis week to tok about Trump in such a way wey fit bring great sympathy for you and help finish am. You dey interested?", Wolff write to Epstein.
A third email wey Democrats bin release get January 2019 date, during Trump first term for office.
Inside am, Epstein tell Wolff: "Trump bin ask me to resign" apparently im dey refer to im membership for di president Mar-a-Lago club, im add say, im "no eva be member ever".
Epstein add say "of course im bin know about di girls as im bin ask Ghislaine to stop".
Responding to di release for one video wey im bin post to Instagram, Wolff bin tok say: "Some of di emails na between Epstein and me, wen Epstein bin dey discuss im relationship wit Donald Trump."
"I bin don dey try to talk about dis story for veri long time now," im add.
Andrew bin mail Epstein for 2011
As well as Trump, one document wey dem bin release also mention Andrew Mountbatten-Windsor, former Prince Andrew.
Im bin respond to one email wey Ghislaine Maxwell bin forward via Jeffrey Epstein for March 2011 about alleged sexual activity wit one masseuse wey dey work for Epstein.
Andrew reply read: "Hey there! Wetin be all dis? I no sabi anytin about dis! You must TOK am like dat abeg. Dis no get NOTIN to do wit me. I no go fit take any more of dis."
Maxwell bin forward di "right of reply" email from di Mail on Sunday on 4 March, wey sama plenti allegations about Maxwell, Epstein, and di former-Prince Andrew.
Di right of reply email state say one woman, wey dem bin hide her name for di released document, bin dey introduced to Andrew by di disgraced financier for 2001, for Maxwell house for London wia she bin have sex wit Andrew.
On 6 March 2011 di Mail on Sunday bin publish one story including di foto of Prince Andrew and Virginia Guiffre.
Andrew bin always deny any wrongdoing and neva face any charges.
Peter Mandelson bin contact Epstein for 2016
Lord Peter Mandelson, wey dem bin sack as di UK ambassador to di US for September over im links to Epstein, also dey mentioned for di new documents.
Dem show say im bin dey in contact wit Epstein as late as 2016, according to di documents.
Di latest previous reported contact between di pair na wen di den-business secretary bin take advice from Epstein for one banking deal for March 2010, just months afta dem bin release di American businessman prison for child sex offences, as tori pipo Daily Telegraph bin report.
One email from Epstein to Lord Mandelson on 6 November 2016, shortly afta di peer birthday, say: "63 years old. You made it".
Lord Mandelson reply less dan 90 minutes later wia im tok say: "Just. I don decide to extend my life by spending more of am for di US".
Epstein den reply "for di Donald White House", im bin dey refer to di US presidential election wey suppose hapun later dat week.
Epstein continue to say "you bin dey right about staying away from Andrew. I bin dey right for you to stay wit Rinaldo [sic]", wey make reference to Lord Mandelson -husband now wey be Reinaldo Avilda da Silva.
Lord Mandelson don repeatedly tok say im regret im relationship wit Epstein. Im decline to comment on di emails wen di BBC approach am.
Wetin di survivors bin tok
Annie Farmer, one of Epstein accusers and one key witness for Maxwell sex trafficking trial, bin share one statement afta dem bin release di emails.
Inside am she tok say: "Di more information wey come out about Jeffrey Epstein, di more questions we dey left with. Survivors deserve more dan small-small information."
Farmer bin demand di "full release" of di so-called Epstein files and tok say "di estimated one thousand women and girls wey bin dey harmed by Epstein and im associates deserve full transparency".










