'Me and Wike don bury di hatchet' - Fubara tok for state broadcast as e resume work

Wia dis foto come from, RSGH Media
Rivers State Govnor Siminalayi Fubara say e and FCT minister Nyesom Wike don accept to 'bury di hatchet' and allow peace reign for di state as e return afta six months of suspension.
Govnor Fubara address di pipo of River State for im broadcast for Friday 19 September, 2025 wia e say di six month state of emergency rule for di state dey challenging.
Remember say Nigeria President Bola Tinubu bin announce six month state of emergency for River State for 18 March, 2025, sake of di kasala for di oil-rich state.
Now wey di six months don end and di President announce di return of di govnor and di House of Assembly members, Fubara say im choose to cooperate wit di emergency rule dat time sake of make peace reign.
E say all di parties wey dey involved for di kasala wey happun bifor don calm down and dem reconcile to work togeda.
"For di course of di six-month period, Mr President graciously make di peace process wit all di parties dey successful.
"Our Leader, His Excellency, Nyesom Ezenwo Wike, CON, all members of di Rivers State House of Assembly and I, as your Govnor, don accept to bury di hatchet and embrace peace and reconciliation for di best interest of our dear Rivers State," di govnor tok.
Govnor Fubara say im believe say di political crisis wey dey rock di state don dey behind and say peace don return to Rivers State, but not "witout di hard lessons we learn from di emergency rule".
Oda tin Fubara tok for im state address
Fubara say as govnor, e accept to abide by di state of emergency declaration and choose to cooperate wit Mr President and di National Assembly, sake of im conviction and say "no sacrifice dey too great to secure peace, stability, and progress of Rivers State".
E add say im no bother to challenge di state of emergency declaration even though na difficult period for di state.
Fubara clap hand for President Tinubu say e chook mouth to resolve di political crisis for di state dat time.
"We get di duty to ensure say di peace wey we all embrace remain permanent for our dear Rivers State.
"To dose wey express genuine fears, frustrations, and uncertainty ova di nature of di peace process, I assure you say your concerns dey valid but opportunity still dey for necessary adjustments," e tok.
Di Rivers govnor say im go work to make sure say e carry evrione along to return to di path of governance and development by completing di projects wey e don start.
"We gatz rise above bitterness and division and channel our energies to rebuild trust and securing peaceful and prosperous state for all."
Fubara tank President Tinubu, Wike, President of di Senate Godswill Akpabio; di Speaker of the House of Representatives, Abbas Tajudeen; and members of di National Assembly for di role wey dem play to resolve di mata.
'I dey humbled by una love' - Fubara tok as e resume work afta suspension
"I dey humbled by di love una dey show me." Na so Rivers State Govnor Siminialayi Fubara tok as e land Govment House for Port Harcourt.
Di Govnor resume work a day afta President Bola Tinubu lift di emergency rule and suspension on im, im deputy and di state assembly members.
Govnor Fubara resume for Govment House wit im wife, Valerie Fubara and di Deputy Govnor, Prof. Ngozi Nma Odu
E appreciate Rivers pipo, especially di way dem receive am for di Port Harcourt International Airport and even di one wey dem celebrate dey wait for am yesterday.
"Dat reception really humble me. E show una love, confidence and solidarity. No be just celebration becos di number of pipo wey come out and di way una celebrate na reaffirmation wey show di bond between dis govment and di pipo, and I wan assure una say by di grace of God we go continue to do dose tins wey make una love us."

Wia dis foto come from, RSGH Media
Govnor Fubara add say e go do official state broadcast by 6pm on Friday and e go recognise evri pesin wey give support to di return to normalcy.
On Thursday 18 September, large crowd wey gada for Rivers State Govment House in anticipation of di arrival of Govnor Siminalayi Fubara bin dey disappointed afta e fail to resume.
President Bola Tinubu on Wednesday announce say di six months state of emergency e bin impose on Rivers State due to di political kasala for dia, go expire for midnight.
E direct Govrnor Fubara, im deputy, and members of di House of Assembly to resume dia official duties. While di House of Assembly bin resume, di state govnor bin no show up on Thursday.
Thousands of women, youths and supporters of di govnor bin dey celebrate for major streets of Port Harcourt as dem bin wait for di govnor return in grand style on Thursday.

Wia dis foto come from, RSGH Media
Di huge crowd cause heavy traffic jam across di oil rich city as dem march along di streets, dey sing and dance and celebrate di lifting of di emergency rule and restoration of democratic rule for di state.
Many of dem come di Govment House main entrance as early as 6:00am from different parts of di state, including rural areas, but dem begin leave for afternoon, some of dem disappointed and dem no know why di govnor no come greet dem or resume work.
On Friday, some pipo also show for di Port Harcourt International Airport to receive am.

Wia dis foto come from, Martin Amaewhule
On di oda hand, di state lawmakers wey also bin dey suspended along wit di govnor resume plenary on Thursday 18 September, 2025 for di conference hall for di Legislative quarters, Aba Road, Port Harcourt.
Highlight of di plenary na resolution to probe di finances and expenditure of di state under di Sole Administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ibas.
Di lawmakers also ask Govnor Fubara to send di list of commissioner nominees for screening and forward an appropriation bill for consideration.
27 lawmakers na im resume plenary and di oda three wey report say dem loyal to di govnor bin no dey among dem.
Dem adjourn sitting to Monday 22 September, 2025.
Meawnhile former Rivers State govnor and key player for di crisis wey lead to di declaration of state of emergency for Rivers State, Nyesom Wike, for one interview on Channels Television say legal obligation no dey for di govnor to resume immediately on di exact day wey di emergency rule end.
E say, "law no dey wey say e gatz resume work today. Im be di govnor, I no understand di way we operate. Okay, dem swear me in today as di govnor for example, e no mean say I go go di office tomorrow.
You no know wetin my programmes be, you no know wetin di govnor don schedule to do, you no know wia im dey," e tok on top di mata.










