'Bring back Peter Obi, kill PDP' and oda tins Wike tok about 2027

Foto of Nyesom Wike and Peter Obi

Wia dis foto come from, Nyesom Wike/Peter Obi/Facebook

Read am in 5 mins

Federal Capital Territory [FCT] Minister Nyesom Wike don tackle 2023 presidential candidate, Peter Obi.

Wike also chook mouth for di zoning wey di Peoples Democratic Party [PDP] do recently wey dem zone di presidential candidate to southern Nigeria.

For di 102 National Executive Council meeting wey happun recently, PDP bin announce say dem don zone di presidential candidacy to di south. Dis announcement make headlines and cause tok-tok evriwia.

Some pipo come dey add jara say former Presidential candidate for Labour Party, Peter Obi wan go back to PDP. Sometin wey Obi imsef neva react to.

But Nyesom Wike den clear di air about wetin im tink if Peter Obi if e eventually return back to PDP.

Wike tok say if di Peoples Democratic Party bring Peter Obi back as di presidential candidate dem go kill di party more.

"Obi wey bin dey abuse di party say di party dey rotten..., so di party don good now for am for come run for presidency? If you wan destroy dis party dare to bring Obi, make Obi sef come becos e no get wia im neva go sake of ambition, im [Obi] no fit dey principled?"

Di minister tok say, sake of say Obi dey find presidential ambition anywia dem call am Obi dey waka go. E ask if Peter Obi no get principle and idealogy again.

Di former Minister of Education explain say Nigerians no like truth and di pipo wey go tell dem wia dem dey stand.

Im tok say im bin don tell im colleagues since say PDP dey shoot diasef sake of say dem no fit give di presidential ticket and national chairman of di party to di same region.

"I tell dem say e go purge dem and true-true e don purge dem and I no no regret am. Na now dem dey realise say wetin I tok na true...If pipo tok say Wike dey wear mask wetin dem dey wear?" im ask.

Im claim say di same pipo wey dey ginger former President Goodluck Jonathan to contest for di 2027 election na di same pipo wey bin do am ojoro for di 2015 election.

About di emergency rule for Rivers State and di just concluded local govment election wey happun ova di weekend di FCT Minister, Nyesom Wike say im no blame di former presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar.

Wike still face di former Labour Party presidential candidate Peter Obi, say wen e be be govnor, doctors bin dey on strike for 13 good months, hospitals bin shut down.

Im tok say make pipo no take di views of Obi and Atiku sake of say dis two pipo dey vex say dem dey look for wia dem go get funding and now e no dey available for Rivers State again.

Residents of Port Harcourt bin get di chance to choose dia Local Govment Chairmen and Councillors on Saturday 30 August, 2025.

Election happun for all 23 local govment areas of di state and winners emerge.

State of emergency for Rivers state

Wike explain say according to di Emergency Powers of 2004 wey former President Olusegun Obasanjo bin sign into law.

Di law tok say, di president get power to suspend or modify some sections of di law.

Under Emergency Rule dem fit make regulations for di governance of di emergency areas and di president don do all dis tins.

"We say emergency rule dey illegal but we accept military rule to conduct election for us for a democratically elected pipo"

Wike add say under emergency rule some sections of di law dey suspended.

Im explain say di emergency rule wey President Bola Tinubu announce na only for di state Ggovment and di State Assembly and di local govment bin no get any democratic govment sake of di local govment election wey di Supreme Court say dey invalid.

"Bifor now Supreme Court don tok say make no Caretaker Committee Chairmen dey again and if dem no do democraric election for local govment dem no go fit access funds from local govment account. So president no nullify local govment election but na di court nullify am."

Im add say na sake of di emergency rule wey make di Rivers State govment fit access funds from di Federation account becos budget bin no dey.

Wike clear di air say di Sole Administrator of Rivers State, Vice Admiral Ibok-Ete-Ibas get di power to appoint di oga of Risec sake of say im dey representative of President Bola Tinubu and na di same power im dey use.

'I be member of PDP and I still win my local govment'

Wike say na im local govment area Obio/Akpor, Port Harcourt and Ogba/Egbema/Ndoni dey determine wetin dey happun for Rivers State and na PDP win all di three.

About 2027 election Wike say, evri election dey unique, im explain say APC win almost all di LGAs for Rivers State - and wetin pipo suppose ask na weda di residents dey happy about dis victory, anoda question na weda PDP contest for dos local govment areas wey APC win.

"For di first time for di history of dis kontri for election we no hear gunshot, we no hear hijacking of materials, no political party don come out to tok say dem no believe in dis election"