Wike give conditions to forgive Fubara, five oda tins FCT minister tok for media chat

A suspended Nigerian govnor looking straight for di left while im former govnor dey for right pointing fingers wearing dark glass.

Wia dis foto come from, Rivers state Government Press

Read am in 6 mins

Di current Nigeria minister of di Federal Capital Territory (FCT) and former govnor of Rivers State, Nyesom Wike, don tok say im go let go of di ‘wrong tins’ wey im political godson and successor Siminalayi Fubara don cause if e come ask for forgiveness.

Wike tok dis one during one media chat wey im do wit journalist for Abuja.

Di former Rivers State govnor say im go 'sincerely' forgive Fubara if e come beg for forgiveness for im hand.

Wike and Fubara na political father and son wey don look each oda eyes as dem both dey struggle for who go kontrol di political and economic structures for Rivers State.

For January 2024, di Supreme Court bin confam Fubara as Rivers State govnor afta e dismiss di appeal wey Tonye Cole of di All Progressives Congress file ova di 18 March 2023 governorship election.

Since dat time, Fubara neva rest as e dey face one wahala to di oda as govnor.

Below na di key takeaways from Wike media chat:

'I bin want outright removal of Fubara'

FCT minister say wetin e want na di outright removal of Fubara comot for office as Rivers govnor, instead of di suspension wey dem sama am.

Wike say President Bola Tinubu do di to declare a state of emergency for Rivers state.

"As a politician, I no dey happy wit di declaration of Emergency Rule for Rivers state. I want di outright removal of di governor (Fubara)."

But for di interest of di state, di president do di right thing. The governor was gone; they should worship Mr. President.

Wike add say Rivers pipo suppose dey worship di president becos na im save di govnor for inside all of di crisis.

"Evri morning, go to di president and say, 'we fit wash your feet for saving us?'. Supreme don tok say no money fit go to Local govment wen e no dey democratically elected, nobdoy fit go to di State witout appropriation. For dat situation, crisis dey"

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

PDP govnors dey frustrate party 2027 plans – Wike

Former govnor Wike say di PDP govnors no dey truthful to diasef as dem say dem no want coalition for 2027.

Wike wey don dey di govnors forum bifor wen im be Rivers State govnor add say na mata of interest and di party no dey do like say dem wan win for 2027.

"Evribodi wan become president of Nigeria but nobodi wan say make we build our party. Dem just dey find ways to be president. If unity no dey, we no fit do am.

"How many govnors fit tok say na dem dey fund di party or dey pay dia salary. Dem no want coalition, dem no dey truthful to diasef. Na just mata of interest,” Wike tok.

E also react to Oyo State govnor Seyi Makinde tok for interviews wia e say na impunity no make di PDP win for 2023 sake of say some pipo no respect di party.

Wike say im agree wit Makinde say wetin make PDP lose di 2023 elections na impunity from pipo wey no respect di party constitution, but e tell am say im (Makinde) dey also make di same mistake and e fit affect di party again for 2027.

"I call Oyo State Govnor Seyi Makinde say I hear wetin im tok, but im no tok di truth. Dose wey say dem no want coalition for di govnors forum no dey sincere to di party."

‘Anyanwu remain PDP national secretary'

Wike don also tok say di PDP govnors forum no get di authority to comot di national secretary, Samuel Anyanwu.

Dis na afta di PDP govnor forum for dia meeting say dem wan replace di national secretary wit a temporary one.

"Di govnors forum no be organ of di party, na pressure group wey fit put influence for di National Working Committee."

"You no get di authority to say make pesin dey act as national secretary wen a national secretary wey neva resign still dey."

Wike wey still be PDP member say di national secretary na elected position, no be appointment and anyone wey wan remove am go do am through di national convention.

'You no fit do dat, you no get di power. You no fit come out openly to say di govnor forum don meet wit di organ of di party to say dat a national secretary wey dem elect, not appointed, go comot.

"Who you be? If anyone wan comot di national secretary, na through di national convention,” di FCT minister tok.

'Make we allow Tinubu finish im tenure'

Wen di journalists for di media chat ask Wike how 2027 go be for im party, e say na only im state e sabi wetin fit happun.

E reject di accusation say im wan hand ova di south-south to APC for 2027 - e say e no dey im power to do so.

Also, im no see anytin bad for Akwa-Ibom Govnor Umo Eno and Delta Govnor Sheriff Oborevwori, wey both of dem dey back di Tinubu administration. Both of dem na PDP govnors.

Report tok say Akwa-Ibom Govnor Eno dey back Tinubu of APC for second term, leaving out dia own party.

Wen Wike dey react to dis, e say no be anti-party activity and e dey allowed. E add say make dem allow Tinubu finish im tenure.

"Wetin I dey tok like I tok for 2023 be say until 20231, until di position go to di north. Notin wey anybody wan tell me now, na to live harmoniously togeda.

"My interest na my state. If I get any intention to do anytin bad... Make we make sacrifice, make we allow dis man tenure to finish. You no fit say na your own prerogative to dey produce president."

Wike call Peter Obi social media candidate

Wike also tok on why im no support di candidate of di Labour Party Peter Obi during di 2023 presidential election.

Di FCT minister regard Obi as 'social media candidate' and add say di Labour Party candidate bin no get any chance to win di election.

"No, e no get chance to win di election. I no dey go wia you see pipo like dis kain social media candidates. I no dey do social media candidate."

Wike say for Tinubu to win di 2023 election, im don analyse am well. And na becos say e sabi play di game well, na im make am win becos all di policies wey di APC bring dat time no favour Nigerians.

Di FCT minister say Nigeria politics get several oda factors wey dey behind am and no be di best candidate dey always win for election.

"I sidon as politician and analyse di candidate wey dey likely to win. For politics, no be right to say dis na di best candidate.

"For Nigeria politics, so many factors dey involved. Weda APC like am or not, e bin dey veri hard for Tinubu to win di election. No party in goment dat time fit bring dose kain policies dat time but e (Tinubu) survive am,“ Wike add.