Planned impeachment of Rivers state Govnor Siminalayi Fubara - Wetin we know

Wia dis foto come from, Rivers state Government House Media
Rivers state Governor Siminialayi Fubara don hold state security meetings with heads of all di security agencies for di state and with elders on how to address di crises wey dey rock di state.
Dis na after hoodlums set fire to and destroy di main Chambers of di Rivers State House of Assembly on Sunday night.
Police bin shoot tear gas canisters to pursue some youths wey come protest against an alleged impeachment proceeding against Governor Siminalayi Fubara for di Rivers State House of Assembly on Monday.
Security agents from di nearby Rivers State Police Command bin take over di complex afta di hoodlums set di complex on fire around 10:00pm Sunday 29th October 2023.
A series of events from Sunday till now don leave pipo with some questions as to wetin dey happun for di state.

Rivers state get two Speakers of di House of Assembly?
On di morning of Monday 30 October 2023, tori be say di Rivers State House of Assembly wey Speaker, Rt. Hon. Martins Amaewhule preside over resolve to serve Governor Fubara notice of impeachment as dem suspend four oda members indefinitely.
Di four members na Sokari Goodboy Sokari, wey dey represent Ahoada West, Adolphus Oruibienimigha, wey represent Opobo/Nkoro and Victor Oko Jumbo, wey dey represent Bonny and Rt. Hon. Edison Ehie, wey dey represent Ahoada East constituency II as Members of di House.
For statement wey Head of Communication, Rivers State House of Assembly, James Sogulu sign, for di 84th Legislative Sitting on Monday, 30 October, 2023, e say di Rivers State House of Assembly resolve to serve a notice of Impeachment on di Governor of di state, Sir Siminialayi Fubara.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem bin say dem also remove di Leader of di House, Rt. Hon. Edison Ehie, and suspend four honourable Members; Hon. Sokari Goodboy Sokari, wey dey represent Ahoada West, Hon. Adolphus Oruibienimigha, wey represent Opobo/Nkoro and Hon. Victor Oko Jumbo, wey dey represent Bonny and Rt. Hon. Edison Ehie, wey dey represent Ahoada East constituency II as Members of di House.
Presenting di notice of impeachment, di member wey dey represent Omuma constituency, Sylvanus Nwankwo say dem bring di notice of impeachment pursuant to Section 188 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria as amended, and add say di impeachment notice dey based on gross misconduct in di performance of di functions of di office of di governor.
Di impeachment notice, and motions for removal from office of di House Leader, and di suspension of four Members dey signed by 24 Members of di House.
Shortly after dis one happen, Governor of Rivers State Sir Siminialayi Fubara with some Assembly members like Edison Ehie, Sokari Goodboy Sokari and Victor Oko Jumbo go visit di State Assembly Complex to see di level of damage wey di fire outbreak cause but some police personnel wey bin dey guard di Assembly Complex open tear gas and water canon on am and some youths wey bin also follow di governor go di complex.
After di visit, di governor and some assembly members go back to Government House Port Harcourt and soon tori come out say 24 lawmakers don elect Edison Ehie as di Speaker of di 10th Assembly of di Rivers State House of Assembly.
For di official statement wey e sign, Rt. Hon Edison Ehie address Rivers pipo say,
"Regrettably, e don come to my attention say some members of our assembly don fall short of di principles wey dey guide di public service. In light of dia actions, wey undermine di trust and faith una don put upon us, I don take di difficult decision to suspend di defaulting members from dia legislative duties."
Though Rt. Hon Edison Ehie no mention di names of di assembly members wey dey suspended, e say di house dey adjourned sine die, dat is till further notice.

Meanwhile, Governor Fubara address tori pipo on di mata, e say: “e dey unfortunate say Rivers state dey experience dis kain tin nine years after a similar tin happen.
I get distressing information late yesterday and I say I go come see for myself dis morning. Every pesin wey know me know say I be peaceful pesin. Even if I dey aware say plot dey to impeach me for whatever reason, e no worry me. But I dey worried say a facility like dis wey dem use tax payers money build go dey destroyed just ti please sombebodi. E dey unfortunate.
From wetin I dey see, di security dey compromised as dem bin dey shoot at me. Di DC Operations dey shoot directly at me. But e no matter. Somebody go die one day.
I wan die death wey be say wen pipo ask about Fubara dem go hear say na dat man wey die for a struggle. I no dey against anybody and I no dey plan anytin against anybody but I no know wia all dis dey come from. Make e dey on record say whoever mastermind dis tin, I hear say some pipo gada to do whatever. Dat na rubbish becos you no fit seat wen problem dey and you say you dey do anytin, wetin you dey do?
Di governor add say as di chief security officer of di state, na im duty to provide an alternative place for di House of Assembly to sidon so whatever action wey happen for di Assembly complex dey null and void.
Eralier, Governor Fubara sack di Chief of Staff Government House, Chidi Amadi and di Government House Chief Security Officer alais Government House Camp Commandant, Promise Wosu.
How Siminialayi Fubara emerge PDP governor
Siminialayi Fubara, na former accountant-general with di Rivers State Government.
E win di PDP governorship primary election wey dem conduct on di night of Wednesday 23 May 2022 for Obi Wali Conference Centre, Port Harcourt.
E come from Opobo Town in Opobo/Nkoro Local Goment Area of Rivers State.
Fubara poll 721 votes to beat di oda 16 governorship aspirants wey bin contest di primary election as
Isaac Kamalu from Eleme get 86 votes to finish second while Alabo Dakorinama George-Kelly and Tammy Danagogo come third and fourth with 37 votes and 36 votes respectively.
For im appreciation speech, Fubara bin attribute im victory to God’s grace, come add say di victory na for di PDP.
“Grace dey at work. Dis no be victory for Fubara. Na victory for di party. No be just victory for di party, but na for moving di state forward,” e bin tok.
Fubara bin say di essence of im emergence na to consolidate on di success of Governor Nyesom Wike administration.
Den, Governor Nyesom Wike bin describe di emergence of Siminialayi Fubara as an act of God.
“Power comes from God. Wen I become governor, I never know say I go be governor. Make evribodi see am as di way wey God design am,” Wike bin tok.













