Two dead as Anthony Joshua dey involved for fatal road accident for Ogun State

Anthony Joshua

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 6 mins

Police for Nigeria don confam say former heavyweight Boxing Champion Anthony Joshua involve for one fatal road accident wey hapun for Ogun state south west of di kontri on Monday.

Two pipo die for di accident Authorities don reveal dia identity as Joshua coach and personal trainer.

Di Federal Road Safety Corps, FRSC, say di accident involving di British Heavyweight boxer Anthony Joshua na "as a result of overspeeding and wrongful overtaking" according to dia preliminary report.

Anthony Joshua sitdown inside di car wey look scattered, e no wear any shirt, e get small bruises for body, e wear black shorts and black wrist watch.

Wia dis foto come from, Adeniyi Orojo

Wetin we call dis foto, Former heavyweight boxing champion, Anthony Joshua dey inside di Lexus Jeep wey get accident.

Ogun State police commissioner, CP Lanre Ogunlowo, say dem don order make dem begin investigation into di accident.

"I fit confam to you say accident occur and dem don move di victim to di hospital.

"Dem tell me say Anthony Joshua dey involved for dat accident but until dem tell me wetin hapun and how e hapun, I no go speak becos I get di news few minutes back and direct di officer to go di hospital"

Also, di DPO Sagamu, Ode Fredrick say dem dey go hospital to confam di casualties wey dey involved for di accident.

Meanwhile, videos wey dey circulate for social media show Joshua in distress and some oda victims for ground.

Di 36-year-old get family roots for Sagamu, one town for Ogun State.

Di former heavyweight world champion bin dey spend time for Nigeria after im recent fight with Jake Paul on 19 December.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Wetin more we sabi about di crash

Rescue official wear white short sleeve shirt wit orange and white colour reflective jacket. E look like say e dey try tok or stretch im hand to Anthony Joshua wey sitdown inside di Lexus Jeep wey get accident.

Wia dis foto come from, Adeniyi Orojo

Wetin we call dis foto, Foto of official wey dey try rescue Anthony Joshua wey look like say im dey in pain as e sitdown inside di crashed car.

BBC News Pidgin tori pesin, Adesola Akinloju wey dey on ground for di Lagos-Ibadan Expressway way, southwest, Nigeria report say eyewitnesses tok say di truck bin don park for dat place since Sunday 28 December, 2025.

Di driver of di truck leave di truck dia waka comot as im bin dey hope say dem go kon carry di truck go repair sake of di fault e develop. Di truck bin dey carry soya beans.

"Di Lexus Jeep na bulletproof car, di jeep destroy di tyre of di truck wey park for road, di windscreen of di jeep destroy too''

According to im report, eyewitnesses also tell am say afta di accident hapun Anthony Joshua bin no fit come out from di car for like 10 minutes sake of di shock from di accident, until pipo wey gada begin shout im name before im regain consciousness.

Eyewitnesses also tok say three oda cars bin dey for Anthony Joshua convoy.

FRSC confam say di fatal road traffic crash hapun on Monday, 29 December 2025, along di Lagos–Ibadan Expressway.

According to di FRSC, na around di Sinoma area near Sagamu, Ogun State di crash hapun.

Dem say di Lexus Jeep wey bin dey carry Anthony Joshua jam truck wey dem park for road.

For statement, FRSC tok-tok pesin, for Abuja, Assistant Corp Marshal, Olusegun Ogungbemide say preliminary reports from di Ogun Sector Command show say di crash hapun at about 12.00 hours and dem report to di Corps sharp-sharp.

"FRSC operatives arrive di scene within three minutes of notification, wey enable swift rescue operations, evacuation of victims, effective traffic control, and prevention of secondary crashes."

Di statement add say na two vehicles dey involved for di accident, one black Lexus Jeep wit private registration number and stationary red commercial Sinotruck wey get unknown registration number.

According to road safety, na a total of five men, all of dem na adults wey bin dey involved for di crash. Anthony Joshua wey be part of dem get minor injuries.

"Two pesins sadly lost dia lives, one sustain injuries, while two odas escape witout injury. Dem rescue Anthony Joshua alive and e sustain minor injuries."

Di pipo wey wound dey receive medical attention. Dem don also put di deadbody of di pipo wey die for di Livewell Morgue, Ajaka, Sagamu.

Meanwhile di Director General of di National Sports Commission [NSC] for Nigeria don identify di two pipo wey kpai as Joshua strength and conditioning coach, Sina Ghami and personal trainer, Kevin Latif Ayodele.

E identify dem for statement as e thank God say Anthony Joshua survive and also condole wit di families of di victims wey kpai.

Sinotruck wey look like say e carry goods. E dey covered wit cream colour tarpaulin, dem use black ropes tie am for up. pipo gada for di side of di truck. Parts of wetin resemble broken car parts dey for ground. For di left side part of di Federal Road Safety car wey dem paint sky blue and white dey for di left side.

Wia dis foto come from, Adeniyi Orojo

Wetin we call dis foto, Di truck wey park by di side of di road wey di Lexus Jeep go jam.

Di Federal Road Safety for di statement wey dem release tok say from dia preliminary findings dem suspect say di Lexus Jeep bin dey travel beyond di speed limit wey dey approved for di corridor.

"E lose control during one overtaking manoeuvre e kon crash into one stationary truck wey park well by di side of di road. "

Dem add say di primary causes of di crash na excessive speed and wrong overtaking wey constitute serious traffic violations wey dey among di leading causes of fatal road crashes on Nigerian highways.

Anthony Joshua profile

Anthony Joshua na two-time world heavyweight boxing champion.

Im get family roots for Sagamu, one town for Ogun State, Southwest, Nigeria.

Im bin spend some of im early years for Nigeria before im return to Watford.

Joshua bin dey play football for Watford and also be athlete for school.

Tori be say im bin get di habit to enta trouble well-well before im concentrate on boxing.

According to report, im also be former bricklayer. Im win silver medal for di World Championships as amateur.

Im bin also win Olympic super-heavyweight gold for di London 2012 Olympic Games.

For 2013, im become professional boxer and im bin dey undefeated in all im 20 fights as a pro.

For 2019, Andy Ruiz Jr shock evribody as im bin make di biggest history of heavyweight boxing to beat Anthony Joshua.

E collect Joshua IBF, WBO and WBA world heavyweight titles.

Dem born Anthony Oluwafemi Olaseni Joshua for Watford, England, but im dey always tok about im Nigerian heritage.

Joshua family dey popular for Sagamu, for south-west Nigeria.

Im great-grandfather, Daniel Adebambo Joshua, na wealthy landowner and merchant, wey dem believe say bin carry di Joshua surname afta e convert to Christianity.

Joshua always dey proud of im heritage wit im tattoo of di African continent for im right shoulder, wia e write Nigeria.

During im fights, im dey always display di Nigerian flag alongside di Union Jack for di ring.

Im still do di same tin afta im victory against Jake Paul early dis month.

Joshua na sports ambassador for Ogun State.