Anthony Joshua knack stars comot for Jake Paul eyes

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Kal Sajad
- Role, BBC Sport at Kaseya Center, Miami
- Read am in 6 mins
British heavyweight Anthony Joshua need only six rounds to knockout boxing novice Jake Paul, wey bin spend much of di contest for survival mode for one of di biggest mismatch for boxing history.
Joshua almost dey frustrated as Paul bin just dey dance around di ring, but e later put body for di match and knock down di YouTuber-boxer two times for di fifth round.
AJ knock Paul down again for di sixth and den land am powerful right hand to bring di match to conclusion for di Miami Kaseya Center.
Di American no fit beat di count and evribody bin happy as e manage to get up for im feet afta di match and comot for di ring without assistance.
"E no be di best performance," AJ tok afta di fight.
"Di end goal na to pin Jake Paul down and wunjure am. E bin take longer dan expected, but di right hand finally find im destination."
Di result na wetin evribodi for di boxing world bin don predict, and di controversial fight don raise questions about di safety risks wey dey very clear by di big difference between di two fighters in experience, size and power.
Joshua claim di 29th victory of im professional career for 33 outings and e go now turn im attention to more legitimate challenges - may di showdown wit Tyson Fury next year wey many pipo don dey anticipate.
"Come and fight one of di 'realest' fighters out dia, step in dia wit me next if you be really bad boy," Joshua tok as e call out Fury.
Paul, meanwhile, no fit to deliver on im promise to pull off di greatest upset for sports history.
Di 28-year-old spend much of di fight dey tumbling on top di canvas and hugging Joshua legs, a reflection of di big weight gap betwin dem and how badly e bin struggle to cope.
Di social media sensation sha manage to land a few shots, and di fact say di fight even enta six rounds no flatter Joshua at all.
Frustrated Joshua finally lands big

Wia dis foto come from, Getty Images
Joshua bin first receive mix reception as e bin walk into di 20,000-seat arena, but e just bone face to show wetin im bin don dey tok say e go take di fight very seriously.
Paul also walk to di ring with di controversial rapper 6ix9ine wey get history of criminal convictions and prison time.
As di opening bell ring, Paul just deyaround as pipo start to dey boo am.
Joshua watch am small bifor swinging heavy lefts and rights wey just dey catch air, and di crowds dey respond wit evri punch wey e miss. Paul respond by bringing out im tongue, playing to di theatre.
Every passing minute feel like small victory for Paul, who bin fight and win 58-year-old Mike Tyson only 13 months ago.
Di event bin dey broadcast live to more dan 300 million Netflix subscribers.
Golf superstar Rory McIlroy, who just win di UK Sports Personality of di Year, also sit for di ringside alongside rappers Rick Ross and Timbaland.
Di fifth round delivere wetin many pipo bin don dey expect since. A right hook brush Paul shoulder and sent am to di canvas.
Moments later, anoda combination drop am for ground again. E rise heavily and dey breath hard as e attempt to do macho man and hide di damage.
Anoda heavy right for di sixth once again trowey Paul for ground and many pipo for di crowd start to dey ask di referee to step in and stop di fight.
Dose wey remember Joshua brutal one-punch knockout of former UFC heavyweight champion Francis Ngannou last year, bin feel say something like dat fit happun again.
Dis time, e no too dey savage like dat, but di straight right - di punch Joshua bin don dey wait for all night - finally landed, and dat na di end.
AJ eyes Fury, Paul targets cruiserweight title

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis no be contest wey suppose test Joshua boxing ability. Na just entertainment wey dem create to generate attention and revenue.
"I no care about di legacy. All di legacy dey dia to just last for 50 years and e go finish. Dis na wetin I dey do, I go dey do am until I no fit any more," Joshua tok.
Joshua go leave Miami wit im share of a reported purse of £210m and im focus go now shift to anoda warm-up opponent for February bifor a potential showdown wit Fury later for 2026.
Paul imsef later admit say AJ really beat am up, but e insist say e go come bak and target a cruiserweight world title.
"I tink my jaw dey broken. But e dey good, I go come bak and get world championship belt at some point," e tok.
Tori later come out say Jake Paul don check imsef into hospital sake of im jaw wey AJ break.
Weda you like am or hate am, Paul dey always draw di audience, headline and debate in a way few boxers can.
Di fact say e convinced some sections of di public say dis fight fit dey competitive show say e be beta show promoter - even if as a boxer, e don cast.








