Breakdown of Tinubu 2026 budget presentation wey go spend ₦15.52 trillion to service debt

Nigeria president Bola Tinubu dey present 2025 budgets

Wia dis foto come from, PRESIDENCY

Read am in 5 mins

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don present di 2026 budget to a join session of di National Assembly.

E present di budget wey worth ₦58.18 trillion [wey be about $41.5 billion] to di lawmakers on Friday 19 December, 2025.

Oga Tinubu call am di "Budget of Consolidation, Renewed Resilience and Shared Prosperity."

Im explain say di aim of di spending plan na to bring in economic stability, create jobs, and improve di living standards of Nigerians afta two years of painful reforms.

Di total revenue wey dem dey expect na ₦34.33 trillion [$24.5 billion] while di capital money wey dem go spend na ₦26.08 trillion [$18.6 billion].

Nigeria govment say dem go spend ₦15.52 trillion [$11 billion] to service debt. Dem also get a deficit of: ₦23.85 trillion [$17 billion] wey be about 4.3% of Gross Domestic Product [GDP].

Highlights of di 2026 Budget

Security get di highest budget: Di security for Nigeria na im get di highest share of di budget - ₦5.41 trillion ($3.9 billion).

E point to wetin Nigeria govment tok say dem ready fight insecurity.

Wen President Bola Tinubu dey announce di 2026 budget, e also tok about di new security doctrine.

E say under di new policy, any armed group or any group wey dey ginger odas to dey operate outside state authority go dey classified as terrorist.

Dis tok wey President Tinubu tok include bandits, militias, kidnappers, cult groups, and di pipo wey dey sponsor dem.

E say political and community figures wey dey also cause kasala or support violence follow for dis group.

Oga Tinubu say di move na part of "holistic reset" of Nigeria security architecture wey go tackle terrorism, banditry, and kidnapping wey don become threats wey dey live wit Nigerians now.

Observers say persistent insecurity don slow down investment for Nigeria. E don also scata farming wey don make inflation for food worse and to build peace di veri important for di economy to recover.

Economic mata: President Tinubu tok about some progress wey im administration don make for di economy.

Im explain say inflation don fall to 14.45% from 24% early dis year while foreign reserves don climb to $47 billion, and di confidence of investors don dey come back.

Many Nigerians dey happy as inflation dey fall and di student loan wey pipo for tertiary institutions fit access, but pipo still dey worry about di debt wey dey rise and di cost of living.

Oda areas wey get allocations include

Infrastructure: Get ₦3.56 trillion ($2.5 billion) and e go be for building of roads.

Education: Get ₦3.52 trillion ($2.5 billion).

Health: Get ₦2.48 trillion ($1.8 billion)

Total expected revenue: Na ₦34.33 trillion ($24.5 billion)

Capital spending: Go be ₦26.08 trillion ($18.6 billion).

Debt servicing: E go cost ₦15.52 trillion ($11 billion).

Deficit: Na ₦23.85 trillion ($17 billion) -wey be about 4.3% of GDP.

Sabi pipo dey warn say di confidence go depend on weda di reforms go translate into real improvements.

Tinubu promise Nigerians say dem go dey strict and discipline for revenue collection and spending.

Im declare say, "Di greatest budget no be di one wey we announce, but di one wey we deliver."

Wetin di 2026 budget suppose focus on?

Bifor President Tinubu announce di budget, one political analyst wey follow BBC News Pidgin tok, Henry Olonimoyo, bin say make di federal govment make clear issues wey dey surround how dem take implement previous budgets.

Olonimoyo tok say concern dey grow say some parts of di 2023 and 2024 budgets fit never fully execute, as e stress say transparency dey important before dem introduce anoda new budget.

"I for like make di govment also clear existing issues wit di previous budget, sake of say e look like say some insinuations dey say some parts of di 2023, 2024 budgets never still execute," e tok.

E note say even wit directives and provisions wey dem put for improvement, several projects neva still get implementation.

"We get directive say some of di tins wey dem provide for improvement neva still execute, and now we dey get anoda 2026 budget.

I hope say either di presidency or person from di Ministry of Budget go enlighten di nation make we sabi wia we dey as e concern di performance of our budget," Olonimoyo add.

Di analyst also kwesion di govment claim about revenue, as e note say wetin officials dey tok no dey match wetin contractors dey report.

"And of course, di president don tok am many times say e don experience plenty revenue dis year or so, say e don reach im revenue target.

But from di gist wey we dey hear, contractors never get paid, issues dey. So we get revenue problem? Di president suppose come out clear dis matter," e tok.

As dem dey plan now to introduce di 2026 budget, Olonimoyo call on di govment make dem focus on important sectors wey dey affect Nigerians everyday life.

"Den as we dey plan now to introduce di one for 2026, govment suppose look into key areas like agriculture, security too, because of our present challenge, and of course, infrastructure," e tok.

E stress say infrastructure development no suppose only focus on flagship projects.

"No be only to concentrate on di coastal highway, because dat one dey im own class, but di state or federal roads across di nation, I believe say dem need serious attention as we dey look into di 2026 budgets," Olonimoyo tok.