Tinubu 2025 budget fit solve Nigeria economic wahala?

Wia dis foto come from, ASIWAJU BOLA AHMED TINUBU/FACEBOOK
President Bola Tinubu present di 2025 appropriation bill bifor di 10th National Assembly on Wednesday 18 December.
During di plenary di president present di budget titled "Budget of Restoration: Securing Peace, Rebuilding Prosperity."
Dis na di second budget wey Tinubu dey present as Nigerian president.
Di president give breakdown of di 49.7 trillion naira proposed budget to di National Assembly and wetin dem go allocate for each sector of di economy.
President Tinubu tok say di 2025 budget go drive inflation from 34.6% to 15% in 2025 while di exchange rate go improve from approximately 1,700 naira per US dollar to 1,500 naira, and base crude oil production go increase to 2.06 million barrels per day (mbpd).
But many pipo for Nigeria dey wonder if dis budget fit improve di economic struggle di kontri dey face.
Economic expert Prof Kabir Isa Dandago from Bayero University Kano say wahala dey wit di time wey dem present di budget, e no follow as dem dey do bifor.
"Dis na di first time wey dem delay am reach middle of December bifor dem present am."
"Normally, dem dey present budget for September or October so lawmakers go fit review am well and finalize am by January."
Di N48 trillion budget dey depend on oil money, tax, and loans. Sake of di oil money wey dem dey expect no go fit cover di budget.
Prof Dandago explain say di budget big well, and if dem fit do wetin go reduce inflation well, e fit help di economy and reduce di financial wahala wey pipo dey face now.
"Di budget tok say dem go reduce plenty tins, like inflation. Dem plan say inflation go reduce by 30 percent out of 100."
"E still tok say for di budget dem say dem go improve agriculture, natural resources, help business people, and give healthcare for women and children."
If di money dey and dem do di plans wit truth and honesty, na sometin wey pipo go like if di plans work well, di prof add.
"But di problem be say for years, we don dey see dis kain budget, and by di end of di year, e dey always turn disappointment."
Pipo fit suffer more wit poverty and hardship if e go wrong
Prof Dandago warn say if di predictions inside di budget no work, Nigeria economy fit face bigger kasala.
"If wahala dey wit di crude oil predictions or naira lose im value, e go spoil di economy, and pipo go suffer more wit poverty and hardship."
"Di exchange rate prediction wey dem tok, 1,500 naira to one dollar, e too high. Dem suppose do wetin go make dollar no pass 1,000 to 1,100 naira."
"Wen president [Tinubu] enta office, dollar no reach as e dey now. Dem don dey make dis kain prediction bifor, but e dey always fail for end."
On top crude oil mata, Prof Dandago suggest say Nigeria suppose dey sell am inside di kontri.
"Instead of to dey go export crude oil outside di kontri, Nigeria suppose use di refineries for hia and sell am to companies for naira price, no be dollar price. Dis one go mean say dem no need to dey export crude go anoda kontri."
Dis idea fit help di economy if crude oil business dey local for Nigeria.
Evri budget suppose try improve pipo life, from di first level oda level.
But Prof Dandago tok say since Nigeria return to civilian rule, di national budget neva bring any big progress.
"Since di return of civilian rule for Nigeria budget neva bring any big progress for di kontri. Na wetin dey make pipo dey always see wetin dem dey do as propaganda."









