Why Canada deny asylum to Nigerian politician

Wia dis foto come from, Getty Images
Canadian court for Toronto don reject di asylum application of Nigeria politician Adams Omozakari Ayonote.
Oga Ayonote na member of di oppostion Peoples Democratic Party (PDP).
E bin claim say im life dey at risk for Nigeria becos im don survive several gun shot attacks and wen even im return to Nigeria e go face brutal attack from di ruling party, All Progressives Congress (APC).
But di Refugee Protection Division (RPD) deny im application on grounds say im claim lack credibility, as im fail to establish di attacks wey don happun to am in di past.
"Di RPD deny di applicant claim on di basis say e fail to credibly establish di core of im claim. E find insufficient evidence to connect di events of 2005 to di APC, and consider say di applicant make up di events of 2014," di tribunal tok.
"Di RPD find di applicant vacations to di United States in 2014 and 2015 and im return to Nigeria afta each trip to dey inconsistent wit di applicant claim of fear of persecution in Nigeria."

Wia dis foto come from, Getty Images
During di hearing of di case, di court no find any basis in di RAD decision to support di applicant argument on "attempted assassination".
Di court base dia decision on di applicant inconsistencies and omissions of im own evidence.
Tribunal say anoda error from di applicant na say e fail to credibly establish forward-facing fear in light of im travel to the United States in 2014 and 2015 and im return to Nigeria afta each trip.
"Di applicant explain say e don realise how serious di threats dey to im life only afta di escalation of di situation following di airport attack in 2018. E suggest say dis explains why e return to Nigeria afta each of im trips to di United States in 2014 and 2015. Di applicant say e seek police protection in 2014 and live in hiding," di tribunal tok.
While delivering im judgment on November 15, Whyte Nowak say e agreed wit Refugee Appeal Division ( RAD) say Ayonote claims na speculations as im fail to reasonably explain why e dey appear for public gathering in 2018 despite claim say dem to dey live in hiding for fear of im life.
Justice Whyte tok say di applicant fail to explain why e no claim refugee status at di first opportunity in di United States in 2014 and inconsistency dey between im claim say e no run commot wit im family in 2014 becos im no fit afford am.
Justice Whyte say afta considering both parties submissions and take am into di applicable law account.
E find say di applicant fail to show say RAD decision dey unreasonable and den dismiss di case.
Wetin di Canadian law tok about aslyum seekers
Di Canadian ministry of citizenship say refugee claimant dey considered Convention refugee under section 96 of di Immigration and Refugee Protection Act (IRPA) wia dem dey face "more dan mere possibility" of persecution if dem return to dia kontri of nationality.
Di claimant must demonstrate on balance of probabilities say dem both dey subjective to fear objective basis dey for dia fear (Adjei v Canada (Minister of Employment and Immigration), [1989] 2 FC 680 (FCA) at 682-683).
Also di claimant dey considered "pesin in need of protection" under subsection 97(1) of the IRPA wia dem dey establish on objective basis say dia "substantial grounds na true " dem dey face personalized danger of torture, risk of cruel and unusual treatment or punishment, or threat of death if dem return to dia kontri of nationality (Li v Canada (Minister of Citizenship and Immigration), 2005 FCA 1 at paras 29, 33).










