South Africa declare state of disaster afta days of serious bad weather

Flooded road for SA afta heavy rains and violent winds for Cape Town

Wia dis foto come from, Lulama Zenzile/Gallo Images via Getty Images

Read am in 2 mins

Di South African govment don declare di serious bad weather wey dey affect many province across di country as "national disaster."

Authorities for South Africa tok say di classification ana afta di heavy rain, flood, thunderstorm, damaging wind and snowfall wey don damage infrastructure and affect essential services for Western Cape, Eastern Cape, Northern Cape, North West, Free State and Mpumalanga states.

"Dis classification come afta dem experience heavy weather from 4 May 2026, wey include heavy rain, flooding, thunderstorm, damaging winds and snowfall across di Western Cape, North West, Free State, Eastern Cape, Northern Cape and Mpumalanga provinces," Legadima Leso, tok-tok pesin for di Department of Cooperative Governance and Traditional Affairs tok.

Dem neva give update on di damages wey di bad weather don cause yet.

Elias Sithole, di head of national disaster management center for SA, declare di situation as "national disaster."

Sithole tok say di national classification of di bad weather as "disaster" go put di responsibility to manage di disaster on di national govment.

Sithole call for di national govment make dem strengthen support for di disaster management structure so dem go fit implement dia plans to make sure say measures dey in place to help di national executive to effectively deal wit di effect of di disaster.

E also recommend make di national, provincial and municipal govments implement "multisectoral prevention, mitigation, relief and rehabilitation plan" to tackle di effects of di disaster.

In Western Cape province, di Garden Route District Municipality inside one statement on Sunday morning tok say some areas still dey isolated while some communities no get electricity while non-governmental organisation dey help share food to di affected communities.

"At dis stage, many pipo still dey cut off in di affected areas,"'e tok.

"Humanitarian relief teams dey continue to share food parcels and blankets to di communities wey dey affected."