Jamb set cut-off mark, release new policy for candidates wey wan do courses on education and agriculture

Wia dis foto come from, Jamb Website
Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don announce new policy for di candidates wey dey seek admission into education and agriculture related programs.
Dem also set cut-off marks for Universities, polytechnics and colleges.
Jamb on Monday say candidates wey go apply for higher institution admission into education programs no go need UTME.
Dem add say candidates wey dey find admission for agriculture programs too no go need do UTME wen dem apply for di admission.
Jamb say dose courses dey exempted from UTME as di prospective applicants no go need to write di exam.
"Candidates wey dey find admission into Education Programs and Agriculture non-Engineering Courses now dey exempted from UTME," Jamb write.
Jamb hold dia 2026 Policy Meeting on Monday 11 May 2026 wey di Minister of Education, Tunji Alausa lead.
Na for di meeting dem adopt some guidelines for di 2026 admission exam into all tertiary institutions for Nigeria including di determination of di minimum scores for admissions.
Meanwhile, for dis year Jamb examination, na ova 2.2 million candidates sit for di Computer-Based Test wey hold for 989 centres across di kontri.
For April 2026, di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) release di first batch of results of 632,788 candidates wey write di exam on di first day.
According to Jamb tok-tok pesin, Benjamin Fabian for post on im verified X handle, im tok say, "pipo wey write di exam on Thursday, 16 April 2026, fit check dia results wit di UTME RESULT wey dem go send through SMS to 55019 or 66019 wit di phone number wey dem use during registration.
For di policy, jamb also set di age wey candidates fit enta Nigeria tertiary instituions.
Jamb say di age-limit for admission into tertiary institutions na still 16 years.
Jamb set cut-off mark for 2026/2027
Di Nigeria exam body also set cut-off mark for admission into universities.
Jamb say dem go retain 150 as 'di cut-off mark for admission into universities for di 2026/27 academic session.'
Di cut-off mark into polytechnics na 100 while dat of college of nursing go be 150 too, accoridng to Jamb announcement.
According to Jamb, e say dem reach di agreement wit head of tertiary institutions in Nigeria.
"Di Heads of Tertiary Institutions for Nigeria don unanimously agree say di Minimum Admissible Scores for admissions into Universities gatz be 150, Colleges of Nursing, 150, and Polytechnics, 100.









