JAMB release breakdown of how 2025 results be

JAMB logo

Wia dis foto come from, JAMB

Read am in 4 mins

Di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, don release breakdown of how di 2025 results be.

According to JAMB, na about 1,955,069 candidates bin write di 2025 UTME examination. Out of dat candidates, ova 50 per cent score below 200.

Na only 4,756 candidates score 320 and above, while 12,414 candidates score 300 and above, according to JAMB analysis.

"As part of di results, 40,247 underage candidates dey permitted to demonstrate dia exceptional abilities. Howeva, only 467 of dis candidates (1.16%) bin achieve scores wey meet di point for exceptional ability as defined for di UTME, wit dia performance for di subsequent three stages still pending," JAMB tok.

JAMB say out of di total number registered, 97 candidates dey involved for examination palava, while 2,157 odas currently dey undergo 'investigations for suspected malpractices.'

Di exam body say 71,701 candidates dey absent while dose wey face biometric challenges go dey investigated and dose wey dem clear go rewrite di 'examination for designated centres.'

Di 2025 unified tertiary education exam bin start on Friday 25 April and e end on Monday 5, May.

UTME na entrance exam for students wey dey seek admission to enta Nigerian public and private universities.

Dis exam, na Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) dey organise am.

A screenshot of JAMB result analysis

Wia dis foto come from, JAMB

When JAMB go release di 2025 UTME result?

JAMB no give date wen dem go release di 2025 UTME result.

For inside post for dia X handle on Tuesday 29 April JAMB say ''We go release di 2025 UTME results as soon as we complete all post examination analyses and oda procedures''.

''Candidates dey patient please'', JAMB add.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Dem advice candidates to follow dia official channels— website, verified social media accounts for updates.

How to check your JAMB result?

Once JAMB officially release di results candidates fit check dia score through dis method.

SMS method:

Send "RESULT" to 55019 or 66019 wit di phone number you use to register.

You go receive SMS wit your score details.

Candidates no need to go any CBT centre or cybercafé to check results.

Di results wey dem still dey process and di ones wey dey absent go receive message like "under processing" and "absent" respectively.

Those wey dey under investigation go receive:

  • Verification Investigation
  • Under Investigation (A)
  • Under Investigation (B)
  • Alleged Infraction

Wetin your Jamb score mean?

If you see your result. Di big kwesion you go ask yourself na if e dey good enough?

Dis na wetin you need to consider:

Jamb cut-off marks:

JAMB dey set a general minimum cut-off mark for university dem:

Last year Jamb bin approve 140 as di cut-off mark for 2024 admission for universities and 100 for Polytechnics and Colleges of Education (COEs), respectively.

But dis na just baseline becos, each school and course get dia own cut-off mark, and courses like Medicine, Law, and Engineering dey require score of ova 200 and above.

Post-UTME preparation

To meet JAMB cut-off na just di beginning of di admission process. Most Nigerian universities dey conduct wey dem dey call Post-UTME screening, wey include:

  • Written test (CBT or paper)
  • Screening of O'Level results (WAEC/NECO)
  • Online registration and form submission

Some schools dey focus more on di second one, while odas dey use only screening or a combination of both.

To prepare:

  • Get past questions for your school Post-UTME.
  • Study relevant subjects, especially if na test-based screening.
  • Pay attention to deadlines for registration

Admission timelines and wetin to expect?

Afta Jamb and Post-UTME, di admission journey go kotinu through dis stages:

JAMB CAPS (Central Admission Processing System):

Dis na wia schools go upload admission offers and candidates fit:

  • Accept or reject offers
  • Check admission status
  • Upload O'Level results

To access CAPS:

  • Log in at CAPS
  • Click "Check Admission Status," den go to CAPS.

First, Second, and Supplementary Lists: Dis admissions dem, dem dey release dem in batches:

  • Merit (First List): For top scorers.
  • Second List: Dis na for those wey just miss merit or dey for less competitive categories.
  • Supplementary/Change of Course: Dis na for candidates wey no meet departmental cut-offs but dem fit qualify for oda programs.

Change of Institution/Course:

If your score no meet your desired course or school requirement, JAMB allow you to Change your course or institution (up to 2 times).

Na online dem dey usually do am with a small fee.

Admission letters and registration:

  • Once you don accept di offer:
  • Print your JAMB admission letter.

Begin your school registration process (acceptance fee, clearance, and course registration).