All you need to know about Jamb 2025 registration

Jamb candidates during CBT exam

Wia dis foto come from, JAMB

Read am in 4 mins

Every year millions of Nigeria students dey write di Unified tertiary matriculations examination.

UTME na entrance exams wey pipo wey dey find admission to enta Nigeria public and private universities dey write.

Wen Jamb 2025 registration dey start?

Dis year di registration go start on Monday 3 February and end Saturday 8 March 2025.

Di Joint admission and matriculation board wey dey organise di exams release informate about dis year exam.

Jamb say dis year, dem no go consider any candidates wey dey less dan 16 years old by 30 September 2025.

But dem also say any candidate wey dey less dan 16 years old by 30 September 2025 and dey exceptionally brilliant, dem fit consider dem.

Di exam body say dem go confam by say true- true di pesin sabi book well bifor dem fit give di pesin waiver for admission.

Part of how dem go take check say true- true di candidate dey brilliant im must score nothing less dan 80% for each of di UTME/ A Level, PUTME, SSC and for di exceptional candidate examination.

So wetin be di step by step process of 2025 UTME/DE registration?

How to create profile for UTME registration

Di first step na say evri candidate go create dia own profile and to do am, dem go need to use a unique mobile phone number for dia registration.

Dis unique phone number na only one candidate fit use am.

Na dat number wey go be di candidate unique identification for all of dia transaction wit Jamb weda for present or for future..

Candidate go also need dia National Identification number (NIN) for dis process.

No use post-paid or special bundle package lines, dem no dey work unless dem load dem specially wit credit.

Afta di candidate send di text, e go receive a Profile Code for di same phone number. Returning candidates for previous years go still receive di same profile code for di same number wey dem bin use bifor.

Di mobile phone number wey Jamb use for text messages automatically dey tied to di candidate name, dem go use am for future application, examination and admission.

Jamb go den send e-PIN as text message to di candidate phone.

Candidates go present di profile code and e-PIN for any Jamb accredited CBT.

Di application no go complete until dem capture di candidate biometrics and physically take dia photo. Nothing like submission of passport.

Successful capture of biometrics and photograph go authorise candidate to print dia e-registration slip.

Candidates mu.t use at least two fingers, dem fit use any two to print dia registration slip

Jamb go require di candidate fingerprint for any further verification for dia profile

Group/school based registration for candidates dey allowed?

Jamb no dey allow group/ school based registration of candidates.

Na only candidates wey dia biometric verification dey successful Jamb go allow to write di UTME or mock exam.

Parents no dey allowed to make any transaction for candidate profile.

Candidates wey get biometric challenge fit only register for Jamb national and state office dem. Logistics arrangement go dey organised for dis mata through Jamb state offices.

Na for Abuja candidates wey get biometric challenge go write di exam on di last day of di national examination calendar.