Who be Amanda Azubuike, first female U.S. Brigadier General of Nigerian origin

Wia dis foto come from, Nidcom/ X
Di Nigerians in Diaspora Commission (NiDCOM) hail Amanda Azubuike wey gbab historic promotion to Brigadier General in di United States Army.
America decorate 57-year-old Amanda Azubuike wey be black military officer of Nigerian origin, as di first Nigerian woman to become Brigadier General in di United States Army.
Chairpesin of NiDCOM Abike Dabiri-Erewa commend Azubuike Ogbonge achievement, she say her achievement na proof to her dedication, resilience, and exceptional service.
"Amanda elevation to Brigadier General no only break new ground but also underscore di invaluable contributions of Nigerians for diaspora to global advancements."
Amanda for one interview wit Voice of Africa tok say, she dey always feel di pressure to do more and dat make her work harder sake of say sabi say she dey one male dominated field.
"I sabi say many times wen I enta di room I be di only female or I be di only pesin of colour in dat room and I put pressure on myself."
"I tink say wetin make me successful na hard work, I no necessarily be di smartest student but I really work hard"
Tins to know about Brigadier General Amanda Azubuike
Dem born Amanda Azubuike for London, United Kingdom.
Her father na Nigerian of Igbo descent and her mama na Zimbabwean.
Her papa bin comot Nigeria for young age to study law in di UK, na dia e meet her mama, wey be one young nursing student.
Amanda Azubuike begin her military career wen her mama relocate to di U.S. wit two children, Amanda, and her sister afta she divorce dia father.
Ms Amanda become US citizen in April 1989.
Wit di aim to join di US Air Force, Azubuike bin join di Air Force Junior ROTC, one organization wey dey provide citizenship training and aerospace science program for high school students for age 17 during her days for Jacksonville High School.
She graduate from di University of Central Arkansas wit Bachelor's degree in Communications in December 1993.
She den join di Army in 1994 as aviator afta she graduate from di Army Aviation Officer Basic Course.
One year later, Azubuike graduate from flight school as UH-1 pilot and begin her military career at Hunter Army Airfield in Georgia as platoon leader wit di 924th Aviation Support Battalion.
She bin join di 3rd Military Intelligence Battalion (Aerial Exploitation) in South Korea as Operations Officer and RC-12 pilot afta she complete di Military Intelligence Captain Career Course and Fixed Wing Multi-Engine Qualification Course.
Amanda gbab her Master of Professional Studies in Public Relations and Corporate Communications from Georgetown University.
Amanda Azubuike get plenti years of experience in career of over 30 years.
She bin later go into strategic and leadership roles, work in intelligence, public affairs, and senior advisory positions.
She bin serve as Deputy Commanding Officer for di US Army Cadet Command, Chief of Public Affairs for di US Southern Command, Senior Military Advisor for di Pentagon, and di first Nigerian female to become Brigadier General in di US Army.






