Jamb registration 2025 postponed - Exam body give new date and reasons

Jamb candidates during CBT exam

Wia dis foto come from, JAMB

Read am in 4 mins

Registration for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) go now

Start on Monday 3 February, 2025, instead of Friday 31 January, 2025.

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) tok dis one for statement by dia tok-tok pesin, Fabian Benjamin, on Friday.

Di exam join-bodi say di change dey necessary to allow di board carry out key adjustments to im registration templates.

Oga Fabian further tok say di change dey necessary partly as di board bin discover say some Computer-Based Test (CBT) centres use mago-mago facilities to get approval and dat na why dem need to further check and corrections and disapprove those kind centres.

Also, di statement add say, "dis adjustments come in light of di recent suspension of certain law programmes for selected universities, as e dey submitted to di Board by di Council for Legal Education.

"Di board acknowledge say di disruption wey dis fit cause to candidates and oda stakeholders and sincerely apologize for any inconvenience," di statement tok.

Dem add say dem go use di additional time to make to make sure say dem do all necessary so registration process go dey easy.

Suspension of Law for selected universities

Earlier Jamb bin announce say dem no go conduct admissions for di Bachelor of Laws (LL.B) programme for eight universities for di 2025/2026 academic session.

Di exam bodi say di decision to not register law programmes for those schools na afta dat of di institutions by di Council of Legal Education (CLE), di highest decision making bodi for legal education in Nigeria.

Di schools wey dey affected na Kwara State University, Malete, Ilorin, Kwara State; Bingham University, Karu, Nasarawa State; Redeemers University, Ede, Osun State; Western Delta University, Oghara, Delta State; and Taraba State University, Jalingo, Taraba State.

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) bin earlier announce di start of registration for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Bifor, Jamb bin say na 31 January candidates fit begin register and e go end for 8 March.

JAMB, bin further tok for di statement on dia X handle say na for all JAMB accredited Computer-Based Test (CBT) nationwide registration go happun.

For Direct Entry (DE) candidates, JAMB say di application documents and e-PIN vending registration go start from 10 March till Monday, 7 April.

However, di exam join-bodi say make di DE candidates know say di registration dey restricted to only di Board State & Zonal Offices.

Oga of JAMB, Is-haq Oloyede for one presentation wit tori pipo bin say di exam bodi don introduce UTME Mock Trial for underage students wey never fit register for UTME.

Di Mock Trial na to help dem prepare ahead of real UTME afta dem for don they reach age 16.

Breakdown amount wey candidate go pay for di 2025 UTME/DE Registration

1. UTME wit Mock-₦8,700

2. UTME without Mock-₦7, 200.

3. Mock Trial Testing for Future Candidates-₦3, 500.

4. DE-₦5, 700.

Dis na di breakdown:

UTME/DE application fee- ₦3,500

Reading Text,- ₦1,000

CBT centre registration service charge- ₦700

CBT Centre UTME service charge-₦1,500

CBT Mock service charge- ₦1,500

Bank charges- ₦500

CBT Mock-UTME centre service charge- ₦1,500.