Which kontri Trump dey eye afta Venezuela?

Donald Trump in a black jacket.

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Tom Bennett
  • Read am in 4 mins

US President Donald Trump second term dey take shape well-well through im foreign policy plans.

E don carry out im threat against Venezuela as US forces capture di president and im wife from dia strong security house for Caracas in one dramatic overnight operation.

As e dey explain how di operation take hapun, Trump bring back di 1823 Monroe Doctrine wey tok say US get supremacy for di western hemisphere – but e rebrand am as di "Donroe Doctrine".

Dis na some of di warnings wey e don give oda kontris under Washington influence for di past few days be dis.

Greenland

US don already get military base for Greenland – Pituffik Space Base – but Trump tok say e want di whole island.

"We need Greenland from national security angle," Trump tell journalists, as e add say di area "full wit Russian and Chinese ships evriwia."

Di big Arctic island wey be part of Kingdom of Denmark dey about 2,000 miles (3,200km) north-east of di US.

Greenland get plenty rare earth minerals wey dey very important to produce smartphones, electric cars and military equipment. Presently, China dey produce rare earth minerals pass US well-well.

Greenland still get strong strategic position for North Atlantic, as e give access to di Arctic Circle wey dey bicom more important. As polar ice dey melt for coming years, new shipping routes go soon open.

Greenland Prime Minister, Jens Frederik Nielsen, respond to Trump tok say di idea say US go control di island na "fantasy".

"No more pressure. No more hidden tok. No more dream of annexation. We dey open for dialogue. We dey open for discussion. But e must hapun through correct channels and wit respect for international law," im tok.

Any attempt by US to seize Greenland go put am for conflict wit anoda NATO member, and e fit put di alliance inside serious trouble.

Colombia

Just few hours afta di operation for Venezuela, Trump warn Colombian President Gustavo Petro make e "watch im ass".

Colombia wey be Venezuela neighbour for west get plenty oil reserves and na big producer of gold, silver, emeralds, platinum and coal.

Di kontri still be major centre for drug trade for di region – especially cocaine.

Since September wen US begin attack boats for Caribbean and eastern Pacific, claiming (witout proof) say dem dey carry drugs, Trump don enter serious quarrel with di left-wing president of Colombia.

For October, US put sanctions on Petro, accusing am of allowing drug cartels to "flourish".

As Trump dey tok inside Air Force One on Sunday, e say Colombia dey "run by one sick man wey dey like make cocaine and sell am to United States".

"E no go dey do am for long," Trump tok. Wen dem ask am if US go carry out operation against Colombia, Trump reply say, "E sound good to me."

Historically, Colombia don be close ally to Washington for di war against drugs, as e dey receive hundreds of millions of dollars evri year as military support to fight drug cartels.

Iran

Iran dey face serious anti-govment protest now, and Trump warn overnight say di authorities for dia go "feel am well well" if more protesters die.

"We dey watch am very closely. If dem start to kill pipo like dem do bifor, I tink say United States go hit dem very hard," e tell reporters inside Air Force One.

Normally, Iran no dey inside di area wey di "Donroe Doctrine" cover, but Trump don still threaten di Iranian govment bifor say e fit take more action, especially afta US strike Iran nuclear facilities last year.

Di strikes hapun afta Israel launch big operation to scata Iran ability to develop nuclear weapon, wey later lead to di 12-day Israel-Iran conflict.

For meeting wey hapun last week for Mar-a-Lago between Trump and Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, dem tok say Iran be top mata for di agenda. US media report say Netanyahu raise di possibility of new strikes against Iran for 2026.

Mexico

Trump rise to power for 2016 come mainly sake of im shout of "Build di Wall" along di southern border wey separate Mexico and US.

For im first day back for office for 2025, e sign executive order make dem change di name Gulf of Mexico to "Gulf of America".

Many times, e don tok say Mexican authorities no dey do enough to stop drugs and illegal immigrants from entering US.

As e dey tok on Sunday, e say drugs dey "pour" pass Mexico enter US and "we go need do sometin," e add say di cartels for dia "strong well well."

Trump tok say e don offer to send US soldiers go Mexico to fight cartels, but President Claudia Sheinbaum don openly reject any US military action for Mexican land.

Cuba

Di island kontri, wey dey just 90 miles (145 km) south of Florida, don dey under US sanctions since early 1960s.

E bin get close relationship wit Nicolás Maduro for Venezuela, wey reports tok say dem dey supply about 30% of Cuba oil in exchange for doctors and medical workers wey dey go Venezuela.

Now wey Maduro don comot, Havana fit dey exposed if oil supply crash.

Trump suggest on Sunday say US military intervention no necessary for dia, sake of say Cuba "ready to fall."

"I no tink say we need any action," e tok. "E be like say e dey go down."

"I no know weda dem go fit hold on, but Cuba now get no income," e add. "Dem get all dia income from Venezuela, from Venezuelan oil."

US Secretary of State Marco Rubio – wey be pikin of Cuban immigrants don long dey call for regime change for Cuba, as e tell journalists on Saturday: "If na me dey live for Havana, and I dey for di govment, I go dey worried – at least small."

"Wen di president tok, you suppose take am serious," e tok.