Man wey burn Quran for 2023 don die for Sweden afta dem shoot am

Image shows Salwan Momika wearing sunglasses, a grey coat and airpods

Wia dis foto come from, Reuters

    • Author, Maia Davies
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

Dem don shoot and kill one man wey cause violent protests afta im burn di Quran, for Sweden, according to reports.

Reports say dem kill Salwan Momika, 38, for one house for Södertälje, Stockholm, on Wednesday evening.

Kasala start afta oga Momika set fire to one of di Islam holy book outside Stockholm Central Mosque for 2023.

Stockholm police tok for statement say dem don arrest five pipo afta di man for im 40s bin dey shot dead overnight.

Dem call officers for one suspected shooting for one house for Hovsjö around 23:11 local time (22:11 GMT) on Wednesday.

Authorities find di man wey police no reveal im name wit gunshot wounds as dem rush am go hospital. Police announce say im die on Thursday morning.

Local tori pipo tok say oga Momiko bin dey livestream for social media around di time wey dem shoot am.

Oga Momika na Iraqi wey dey live for Sweden. For August, dem charge am wit one oda pesin for "agitation against ethnic group" on four occasions during di summer of 2023.

Di judgment wey suppose dey delivered on Thursday bin dey postponed afta di Stockholm District Court say dem bin "confam say one of di defendants don die".

Prime Minister Ulf Kristersson say Sweden security service bin chook hand inside di investigation bicos "na obviously risk wey get link to foreign powers", na so SVT report am.

Kasala bin burst for di Swedish embassy for Baghdad two times, while di Swedish ambassador bin dey expelled from di city sake of diplomatic gbas-gbos.

Swedish police bin give oga Momika permission for im protest wia im burn di holy book, bicos of di kontri free-speech laws.

Di goment later pledge say dem go find legal means to ban protests wey involve burning books for certain circumstances.

Wetin happun for 2023 wen Salwan Momika

Pipo dey burn motor for Sweden

Wia dis foto come from, Reuters

For July 2023, Salwan Momika wey be Iraqi Christian refugee bin get permission to burn Quran for Stockholm for di second time.

E bin no burn am for July as e just march on top of di holy book but for June of di same year, im burn am outside di main mosque for Stockholm.

Police bin refuse at first to give am permission early dat year say e get risk to make Sweden turn "higher priority target for attacks" using di Public Order law to justify di ban.

But di courts overrule di police say di security risks no get clear connection to di planned gathering or di immediate surrounding enough for dem to refuse di permission.

Di law tok say dem fit ban gatherings only if dem be threat to public safety.

For September 2023, di Iraqi anti-Islam activist oga Momika come burn anoda copy of di Islamic book for Varnhemstorget, wey be main square for di city as part of a series of anti-Islam protests.

Group of angry protesters bin gada to try stop di burning wia police say dem throw dem stones and some pipo even carry electric scooters take nack police motor. Several police cars bin also dey burnt in di kasala.

Dis one cause violent riot wey lead to di arrest of three men and 10 odas bin dey detained say dem disturb public order for di city of Malmo.

Dis na even as for August, dem bin charge am wit one oda pesin say dem agitate an ethnic group for di summer of 2023.

Pipo dey fight police to stop burning of Quran

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Police dey intervene as pipo react to burning of Quran

Di fallout to di Quran burning for Sweden

Di Quran burnings affect Sweden internationally sotay dem attack dia embassies and sabi pesin say e cause foreigners to see dem as pipo wey no like Islam.

Many Muslim-majority kontris bin even hala on top di mata.

For July 2023, protesters burn di Sweden embassy for Iraq afta dem hear say di police for Stockholm give permission for more book burning.

Even though Iraq goment condemn di attack and arrest 20 pipo, dem warn di Swedish goment say dem go cut diplomatic relations if dem allow more Quran burnings bifor dem come expel dia ambassador say make e comot di kontri.

Dis na as di Sweden constitution guarantee di right of freedom of expression for any subject wey include "expressions of opinion wey question religious messages or wey fit hurt di believer".

Sabi pipo bin tok say di Quran burnings dey target di book instead of pipo so dem bin no fit use di law wey stop incitement against ethnic groups to ban those gatherings.

Sweden security service bin tok say book burnings and disinformation campaigns don turn di kontri image "from tolerant kontri to kontri wey dey hostile to Islam and Muslims."

Iran, Turkey, Qatar, di United Arab Emirates and Saudi Arabia also protest against Sweden say dem allow make dem desecrate Quran.