Who qualify for di Champions League and wetin go happun next?

Wia dis foto come from, Getty Images
For di first time, we sabi which teams go play for di knockout rounds of di new phase of di champions league, afta di final games for di league phase on Wednesday.
Manchester City don come from behind to beat Club Brugge to enta di play-offs, while Aston Villa and Arsenal don join Liverpool wey already book dia place for di last 16.
Celtic wey bin lose to Aston Villa go dey inside di play-offs also – na so all five british teams also don progress to from di league phase.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis na di teams wey qualify to each stage:
Last 16: Liverpool, Barcelona, Arsenal, Inter Milan, Atletico Madrid, Bayer Leverkusen, Lille, Aston Villa.
Knockout phase play-offs: Atalanta, Borussia Dortmund, Real Madrid, Bayern Munich, AC Milan, PSV, Paris St-Germain, Benfica, Monaco, Brest, Feyenoord, Juventus, Celtic, Manchester City, Sporting, Club Brugge.
Eliminated: Dinamo Zagreb, Stuttgart, Shakhtar Donetsk, Bologna, Sparta Prague, Leipzig, Girona, Red Star Belgrade, Sturm Graz, Salzburg, Slovan Bratislava, Young Boys.
We bin get idea wey team go face each oda for di next rounds – wia City and Celtic go face ogbonge teams for dia play-offs.
Who go face who for di knockout phase play-offs?
Di teams wey don finish between ninth and 24th go play two-legged play-off ties on 11-12 and 18-19 February to decide wey team go enta di last 16.
Di draw go happun on Friday, 31 January at 11:00 GMT (12:00 WAT)... but di teams already sabi wey teams dem get 50-50 chance to meet sake of dia final position on top di league phase.
Celtic or Manchester City go play European champions Real Madrid – wey di oda go meet ogbonge club Bayern Munich.
Teams also sabi di two possible clubs wey dem fit to face for di last 16 if dem progress thru di play-off.
Di winner of di City and Celtic games go meet either Atletico Madrid or Bayer Leverkusen for di last 16.
Na 50% chance say Juventus go meet AC Milan - and Paris St-Germain go face either Monaco or Brest for Ligue one.

Wia dis foto come from, Getty Images
Who go meet for di last 16?
Liverpool and Barcelona no fit meet each oda until di final afta di two teams don finish as di top two for di league phase.
Di Reds go play either Monaco, Brest, PSG or Benfica for di last 16 – wia Barca go face anoda of those teams.
Arsenal wia don finish third go play Feyenoord, Juventus, AC Milan or PSV.
Aston Villa, wey finish for di top eight afta dem beat Celtic, go meet Sporting, Club Brugge, Atalanta or Borussia Dortmund.
Those matches go happun on 4-5 and 11-12 March.
But dem neva go know team exactly dem go meet until di last-16 draw wia go happun on 21 February.
Clubs go know dia potential road to di final by den – wit di draws for di quarterfinal and semifinal wia go also take place on di same day.
Which British clubs fit meet down di line?
Chance dey say Liverpool and Aston Villa fit meet for di quarterfinals if dem both win dia last-16 games.
Arsenal fit meet Celtic or Manchester City for dat round also.
But all go depend on which way di last-16 draw go go. E also dey possible say British teams go meet for di semis or di final.
All dis go become clear afta 21 February wen di draws happun for di last-16 and odas don happun










