Di football club wey get money pass for di world based on revenue generation

Real Madrid dey lift Champions League

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Real Madrid don win Champions League a record 15 times
Read am in 4 mins

Real Madrid don bicom di first football club to make more than 1bn euros as annual revenue, according to analysis wey Deloitte do.

Di Spanish club still dey for number one for di Deloitte Money League study as dem make revenue of 1.05bn euros (£883m) from di 2023-24 season wia dem win La Liga and di Champions League.

Manchester City come second again wit revenue of £708m.

Dem win dia fourth Premier League title back-to-back and di Club World Cup plus including di European Super Cup for di last season.

Paris St-Germain (£681m), Manchester United (£651m) and Bayern Munich (£646m) enta di top five of dI Money League.

Aston Villa enta top 20 afta dem compete for Europe last season for di last time since 2011.

Nine Premier League clubs dey for di top 20 as Arsenal, Liverpool, Tottenham, Chelsea, Newcastle and West Ham still dey wia dem dey for di League study.

Lyon na di only oda new club for di table as Napoli and Eintracht Frankfurt drop out.

Anoda five Premier League clubs dey for di top 30 wit Brighton as 21st afta dem compete for di Europa League for di first time for dia history.

Crystal Palace, Everton, Fulham and Wolves dey ranked 26th to 29th.

Revenue for di top 20 clubs rise by 6% to record £9.47bn.

Matchday revenue na di part of di industry wey don dey grow by di way e dey make money di most. E rise by 11% to £1.77bn. Wetin help am na di increase in stadium capacity, ticket prices and premium hospitality.

Real na im benefit pass from increase for match day revenues as dem make £210m wey be double of wetin dem make last year afta dem renovate dia Bernabeu Stadium finish.

Barcelona drop from fourth to sixth position as di money wey dem dey make for match day revenue reduce by £5m. Dis na bicos dem don dey play dia matches for smaller stadiums as dem dey redevelop Camp Nou.

Commercial revenue na im be di biggest revenue source for di money league. E increase by 10% to £4.14bn and make up 44% of di total revenue. Dis amount increase as dem host non-football live events like concerts.

Tim Bridge wey be lead partner for di Deloitte sport business group tok say, "Money League clubs continue to break records as dia growth dey continue for commercial and matchday revenues."

Total broadcast revenue stay for £3.64bn. Dis na bicos all di big five leagues (Premier League, Spain's La Liga, German Bundesliga, France Ligue 1 and Italy Serie A) dey di same domestic broadcast cycle.

'Di women game dey grow sharparly'

Deloitte analysis for 15 of di leading women clubs wey dey make money show total revenue of ova 100m euros for di first time as e rise by 35% to £98m.

Barcelona still dey for di top for di third year in a row wit revenue wey climb 26% to £15.1m.

Arsenal climb from fifth to second wit £15,1m total money. Dis include 64% increase in matchday revenue to £4.3m wey bin increase sake of di fact say dem host Women Super League (WSL) games for Emirates Stadium.

Chelsea na third (£11.3m), Manchester United fourth (£9m) and Real Madrid fifth (£8.9m), wit eight WSL clubs for di top 15.

Commercial revenue na di biggest revenue source wey make up 66% of revenue for di top 15 clubs as broadcast and matchday revenues both make up 17%.

Matchday revenue bin increase sake of rise in attendance wey push both WSL and Women Championship attendance pass one million for di first time.

Except for Spain Liga F, di leagues of all di big five European football markets get title sponsor.

Jennifer Haskel, wey be di knowledge and insight lead for Deloitte sports business group say, "e dey clear say di women game dey grow sharp-sharp across metrics wey include and even pass money."

"Even women clubs dey expected to resemble di structure and businesse of men clubs. We dey see fundamental shift for recognition of opportunity wey dey come bicos of di welcoming of key differences.".