Arsenal dey reason to sign Benjamin Sesko and latest in transfer news

Wia dis foto come from, Getty Images
Mohamed Salah don set for big Saudi offer, Arsenal get two attacking targets for eye and Napoli dey eye one double raid on Manchester United...
Slovenia international, Benjamin Sesko dey for tok to complete one big Premier League transfer wey fit lead to signing to Arsenal.
Tok-tok bin dey go on bifor wey link am to some top clubs aft aim effect for RB Leipzig for di Bundesliga.
Sesko, 21, don register 13 goals and three assists for 25 appearances for di German side dis season, wey don attract plenti interest from ogbonge clubs.
Tori pipo Telegraph bin report earlier dis week say Arsenal na "long-term admirers" of di striker and ginger to enta deal wit am for summer" for a January deal.
Dem say e no dey impossible but go likely dey "hugely expensive".
Mohamed Salah, 32, don set for one £65m payday to tempt am to leave Liverpool for Saudi Arabia for summer. (Sun)
Real Madrid don stop dia chase for Liverpool Trent Alexander-Arnold, 26, and go return for di England defender in di summer. (Relevo - in Spanish)
End of Di one wey oda users dey read well well
Arsenal dey consider options to increase dia attack wit Sporting Sweden striker Viktor Gyokeres, 26, and Brentford Cameroon forward Bryan Mbeumo, 25, on dia list. (L'Equipe - in French)
Napoli don set to join di race to sign 27-year-old England and Manchester United forward Marcus Rashford. (Sun), external
Manchester United no go allow Rashford to join one of dia Premier League rivals, wit Chelsea, Tottenham and West Ham don show interest to take di forward on loan. (Star)
Napoli also dey confident to sign Alejandro Garnacho, 20, from Manchester United and don offer di Argentina winger five-year contract. (Il Mattino - in Italian), external
However, di Serie A side go face competition from Tottenham for Garnacho. (Football Transfers)
Al-Hilal and Brazil forward Neymar, 32, dey early discussion wit three Major League Soccer sides including Chicago Fire about to join dem. (ESPN)
Brighton don show interest in English centre-back Tosin Adarabioyo, 27, wey bin join Chelsea in July. (Mail)
Bournemouth left-back Milos Kerkez fit dey favour move to Liverpool over Manchester City and Manchester United, wit di Cherries believed to want about £50m for di 21-year-old Hungary defender. (The i Newspaper)
Deportivo La Coruna don turn down one offer from Chelsea for 22-year-old Spanish winger Yeremay Hernandez. (Metro)
City Football Group, di parent company of Manchester City, dey for toks to sign Juma Bah, 18, wey dey on loan for Real Valladolid from AIK Freetong, for im home kontri of Sierra Leone. (ESPN)
West Ham search for striker fit lead dem to make one move for Fulham 23-year-old Brazilian forward Rodrigo Muniz. (Standard)
West Ham wan cut dia losses on Brazilian Luis Guilherme, 18, and sell di forward just seven months afta e sign am. (Times - subscription required)
Manchester United don hold toks wit some clubs, including Real Betis, as dey dem try to offload 24-year-old Brazil winger Antony dis month. (Sun)
Chelsea no likely to sign England defender Marc Guehi, 24, from Crystal Palace dis month afta e recall Trevoh Chalobah, 25, from one loan spell at Selhurst Park. (Mail)
Newcastle United have rejected a bid of £11m from Fenerbahce for 26-year-old English defender Lloyd Kelly. (Athletic)
Aston Villa have started talks with English midfielder Louie Barry, 21, over a new contract amid interest from Celtic. (Football Insider)
Chelsea and France centre-back Axel Disasi, 26, is attracting interest from Juventus, Atalanta and Bayer Leverkusen. (Caught Offside)
West Ham wan bring in Nottingham Forest 27-year-old Nigeria striker Taiwo Awoniyi. (Florian Plettenberg)
MLS side Atlanta United dey hoping to reunite wit Paraguay midfielder Miguel Almiron, 30, and fit pay Newcastle for di region of £11m. (Athletic)
Aston Villa don dey approached by Galatasaray over di possibility of one deal for Brazilian Diego Carlos, 31. (Fabrizio Romano)
Celtic dey close to agree pre-contract terms wit Arsenal Scotland left-back Kieran Tierney, 27, wey im contract dey expire for di end of di season. Di Scottish champions dey also reason to sign am on loan dis month. (Sky Sports)
Everton,Burnley and Sheffield United all get interest to sign Leicester City striker Tom Cannon, 22, afta di Republic of Ireland international dey recalled from one loan spell for Stoke City. (Mail)
Manchester United dey among di clubs wey dey consider £40m-rated Japan and Parma goalkeeper Zion Suzuki, 22. (Talksport)
Arsenal and Italy midfielder Jorginho, 33, wey im contract dey expire for summer, na target for Brazilian club Flamengo. (Sky Sports)
France centre-back Axel Disasi, 26, na di latest player wey fit dey head out of Chelsea sake of lack of game time. (Mirror)
Newcastle don deylook at 27-year-old England and AC Milan centre-back Fikayo Tomori. (Football Insider)
Celtic na one of clubs wey get interest to sign Aston Villa English striker Louie Barry, 21, on loan, but di Premier League side dey check dia options. (Sky Sports)
West Hamdey tok wit Marseille over one deal for 22-year-old French forward Elye Wahi. (ESPN)
Di Hammers don also add Nurnberg Finn Jeltsch, 18, to dia wishlist for di summer but face competition from Premier League and Bundesliga clubs for di German defender. (Florian Plettenberg)
Saudi Pro League chief executive Omar Mugharbel say na "matter of time" bifor one club from di league go sign Real Madrid and Brazil forward Vinicius Junior, 24. (Marca - in Spanish)
Former Manchester United and Spain midfielder Ander Herrera, 35, don set to join Argentine club Boca Juniors from La Liga side Athletic Bilbao. (Fabrizio Romano)
Sunderland join race for Cannon - EFL gossip
Sheffield United don offer £7m for Leicester Republic of Ireland striker Tom Cannon, 22, wey dem don recall from im loan for Stoke. (Football Insider)
Sunderland don also make one bid to sign Cannon, wit one eye to buy di Republic of Ireland international if dem dey promoted dis season. (Sunderland Echo)
Middlesbrough dey advanced toks to sign Hull City left-back Ryan Giles, wey make 45 appearances for Boro while on loan from Wolves in dia 22/23 season. (Football League World)
Cardiff City get interest to sign Danish forward Yousef Salech from Swedish side IK Sirius, wit di 22-year-old 11 goals for 27 league matches last season. (Wales Online)
Blackburn Rovers don make one £1.75m bid for Coventry City striker Brandon Thomas Asante, wit di Ghana international only wey make di start XI once dis season for di West Midlands side. (Sky Sports)
Preston North End dey for toks to sign defender Emir Karic from Austrian side Sturm Graz for just im second spell away from im home country. (Football Insider)
Wrexham dey look potential loan move for Liverpool forward Jayden Danns, however Reds boss Arne Slot never confirmed if di teenager don set to comot from di Merseyside club.
Di Red Dragons also dey eye Sheffield Wednesday striker Michael Smith, wey dey out of contract for di end of di season. (The Mirror)














