'Expect to see attacking football wit plenty goals' – New Super Eagles coach assure Nigerians

Wia dis foto come from, Super Eagles/X
Super Eagles coach Eric Chelle don promise say di team under am go score goals wey go qualify dem for next year World Cup.
Di Nigeria Football Federation on Monday unveil Éric Sékou Chelle di new Head Coach of di Super Eagles for Abuja.
NFF president, Alhaji Ibrahim Musa Gusau once again call on Nigeria say make dem come togeda to support di manager.
Gusau den promise say di football-ruling bodi go give Chelle all di support wey im need to succeed im assignment.
For di ceremony wey hold inside di Media Conference Room of di MKO Abiola National Stadium, Gusau say e dey happy about di confidence wey Chelle don show for dia tok-tok since di past few days.
And e get believe say Chelle go do wit di Super Eagles, di same ginger to turn around dia fortunes for di 2026 FIFA World Cup qualifying series.
"I see di new Head Coach get di right spirit and di right attitude, and I get faith say e go take di Super Eagles to di next level.
"Coach Chelle recognize and appreciate wetin dey ahead of am, and e say e love di challenge. We go dey dia dey give am di necessary support all di way."
Gusau further tok say di coach sign two-year contract, wit di option of anoda year, if e qualify di Super Eagles to di 2026 FIFA World Cup finals.

Wia dis foto come from, Super Eagles/X
Chairman of di National Sports Commission, Mallam Shehu Dikko further tok say e dey satisfied wit di process wey lead to Chelle recruitment by di NFF.
"Football na dat one factor wey dey unite all Nigerians and give dem plenti joy.
"On our part, we dey satisfied wit di process wey lead to Chelle appointment and go support di NFF to make sure say e get di most conducive atmosphere to do im work".
Chelle on im part, tok say e dey excited to land di job to coach one of Africa biggest football names.
"I wan thank my agent, di NFF, di NSC and indeed all Nigerians for dis big opportunity to coach di Super Eagles of Nigeria na amazing job.
"I no take dis appointment for granted. I dey happy and go do my utmost best".
"Football na about scoring goals, so I favour attacking style. I know di expectations of Nigerians and I go settle down and work diligently wit assistants towards di goal to qualify di Super Eagles to di 2026 FIFA World Cup."
Éric Sékou Chelle profile
Eric Chelle no be name wey dey popular for African Football like George Weah, Abedi Pele, Samuel Eto'o, Rashidi Yekini and di rest.
Dis na becos im football career no too loud.
As a player, Chelle bin play for di Mali senior national team only five times.
Im also play for mostly French clubs like Martigues, Valenciennes, Lens, Istres, and Chamois Niortais.
Meanwhile, Chelle don surprise many pipo as a coach. Bifor e become di national team coach of Mali, Chelle bin manage a number of clubs for di French lower league.
Di 47-year-old get coaching experience wit GS Consolat, FC Martigues, MC Oran and Boulogne.
Na for 2022 Mali appoint am as di senior team coach and like play, like play e carry Mali go di 2023 Afcon wey Côte d'Ivoire host.
For di tournament, di Aiglons of Mali reach di quarter finals bifor dem lose to di host nation for extra time. Côte d'Ivoire go on to win di tournament.
Video show as Chelle squat and dem begin pour am water for head afta di loss – im emotional reaction later become one of di highlights of Afcon 2023. Dem sack am on 13 June, 2024.









