Wetin be Storm Goretti wey dey cause problem for UK

Workers dey pack snow from roads
Read am in 5 mins

Storm Goretti wey hit di UK don leave tens of thousands of Britons across di kontri to face serious power cuts, and scatter travel plans and school closures.

Di winter storm bring 99mph winds wey make di Met Office issue a rare red warning for "dangerous, stormy" winds for di south-west.

Officials for West Midlands don warn of di "worst snowfall in a decade" wit 5-10cm of snow on Friday, and up to 15-25cm for some areas.

More dan 43,000 properties no get power for di south-west as at 6am on Friday, according to di National Grid website, while about 14,000 no get power for di West Midlands and 530 no get power for Wales.

More dan 450 addresses for di East Midlands also no get without power till Friday morning, and National Grid tell customers for south-west of England say dem dey try to restore services by 8am.

A number of weather warnings dey in place with an amber warning for snow for Wales and di Midlands, and yellow warnings for snow, rain, wind and ice across di kontri.

Phone signal don begin return to Isle of Scilly mainland

One man for di Isles of Scilly say Storm Goretti deliver an intense few hours of extreme weather wey down trees "like matchsticks".

Jonathan Smith - wey dey run an organic fruit and vegetable farm on St Martin's - say dis cause di power to go off overnight, wey put much of di Isles into serious darkness.

E say many trees don fall down for di area as di wind bin "really dey howl" for early evening yesterday.

"Di power go off about 6pm I think. No water, electricity or phone."

Jonathan say power come back on at about 08:00 today, and na now e fit get phone signal - but only on di island mainland.

Tree wey don uproots inside person compound
Wetin we call dis foto, Di storm don uproot some trees across many areas for di UK

So far, dI Met Office don issue new snow and ice warnings ahead of di weekend, wey cover most of Scotland, Northern Ireland and parts of England.

Storm Goretti now dey move away from di UK - but rain and breezy conditions go still persist, as BBC Weather Simon King tok.

Tens of thousands of properties still neva get power after di storm hit parts of kontri with 99mph (159km/h) winds and heavy snow

Di region dey experience di worst power outages (more dan 40,000) for di South West of England, wia dem issue a rare red "danger to life" wind warning since on Thursday.

Di storm also cause some traffic disruption as Traffic Scotland get 15 warnings in place and some rail networks don totally suspend services. West Midlands Railway say dem no go run replacement buses becos of "uncertain road conditions"

How Storm Goretti dey affect pipo?

One woman for Derbyshire say she don dey grit local roads herself, and a man for Cornwall say e gatz hold im windows shut during di strong winds

19 year old Naomi Pack, suppose travel to Manchester to celebrate her friend 20th birthday but di snow get oda plans.

She tell BBC Newsbeat for Birmingham say she wait for a bus to bring her to di city centre, "but nothing come".

She use Uber go New Street station, wia she find out say all di trains to Manchester dey cancelled.

Just round di corner from wia we tok to Naomi, Idrisa dey go work, trekking on foot through di slush and snow.

E say im usual 15-minute waka already don reach 25 minutes and e still dey count.

But di fitness worker dey look on di bright side and say dis go count as im warm-up. E also dey help any drivers e see dey get difficulties.

"If we see any cars wey dey stuck we go push am," e tok.

Storm Goretti don move on from Cornwall, but di impact still dey

Large uprooted teee wey lie in front of a building

Across Cornwall, clearing up of trees na common sight.

Late last night for St Ives, one big fallen tree block access to one hotel. Several hotel staff no fit drive home and gatz stay di hotel for di night.

Wen day break, dem see di destructive power of di storm as tree surgeons spend several hours to remove di huge trunk and branches.

Di storm fit don move on, but di impact still dey go on. Some staff for di hotel come work early becos dem no get light for house.

Tens of thousands of properties across Cornwall and di Isles of Scilly dey cut off, and during di height of di storm, 55,000 properties bin dey affected.

Dozens of schools dey closed across Cornwall today and public transport services dey subject to cancellations and delays.

Di storm wey hit for night fit mean say di impact no dey as disastrous as e for be and many pipo don take di advice to stay inside dia house.