Eyewitness record moment US immigration agent shoot woman dead for Minneapolis

Wetin we call dis Video, Watch: Police chief describe how di Minneapolis shooting hapun
    • Author, Sakshi Venkatraman
  • Read am in 6 mins

One US immigration agent shoot and kill one 37-year-old woman for di city of Minneapolis, wey spark protests overnight.

Federal officials say di woman, Renee Nicole Good, bin try to run over immigration agents wit her car but di city mayor say di agent wey shoot her act recklessly.

Videos of di incident show as ICE agents bin dey approach one car wey park for di middle of di street. As e dey try to drive off, one of dem point im gun to di driver and at least dem hear two shots. Di FBI dey investigate am.

Trump administration send Hundreds of ICE agents to Minneapolis, for di state of Minnesota, as part of di White House crackdown on illegal immigration.

Videos wey onlookers post for social media appear to show di moment of di shooting, wey hapun around 10:25 local time on Wednesday morning.

From various vantage points, e show one maroon SUV wey dey block one residential street for Minneapolis.

Crowd of pipo, wey be like say dem dey protest, line-up for di pavement.

Law enforcement vehicles appear nearby. Immigration agents pull up to di vehicle wey bin park for di street, dem come down from di truck and tell di woman behind di wheel to get out of di SUV. One of di agents put hand for di driver side door handle.

Another agent position near di front of di vehicle.

E no dey clear exactly how close di agent dey stand or weda di vehicle bin hit am based on di videos wey BBC immediately review.

Di agent open fire as di maroon SUV attempt to drive off.

Dem hear three pops and di vehicle begin to lose control and crash enta one car wey park nearby along di street.

For one post on Truth Social, Trump say dem "viciously" run over one ICE officer. "E dey hard to believe say im dey alive, but im dey recover from hospital now" im write.

Di Republican president also blame di "Radical Left" for "threatening, assaulting, and targeting our Law Enforcement Officers and ICE Agents on a daily basis".

Minneapolis police chief Brian O'Hara say di driver bin dey for her vehicle and bin dey block di road for Portland Avenue. One federal law enforcement officer bin approach her on foot "and she start to drive off".

Picture show police tape wey block off one snow-covered residential street. Two sheriff cars dey for di background wit officers wey stand in front of dem.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Law enforcement surround di area wia ICE agent fatally shot one woman for Minneapolis

US Homeland Security Secretary Kristi Noem say di woman bin dey "stalk and block" officers throughout di day and she bin try to "weaponise her vehicle" in an attempt to run over di officer wey be act of "domestic terrorism".

Di federal agent fire "defensive shots" and im wound too, na wetin Noem tok, before dem treat and discharge am from one local hospital.

Di Minneapolis City Council, however, tok for statement say Good bin dey simply "care for her neighbours" wen dem shoot and kill her.

One car bin hit di same agent wen im bin dey do im work too for June, Noem tok.

She add say ICE operations for di city go continue, and di FBI go investigate di incident wey hapun on Wednesday.

Emily Heller bin tell CNN say she bin dey house wen she bin see di ICE agents wey dey argue wit protesters outside. She tok say she bin hear agents dey shout for one woman wey dey drive one SUV, den one agent try to open her car door, and di driver reverse di car and start to pull away.

"One ICE agent step in front of her vehicle, im tok, 'Stop!' and den - I mean, she bin don already dey move - and den, point blank, im shoot her through her windshield for face," Heller tell di US network.

Minnesota State Govnor Tim Walz also push back on federal accounts of di incident.

"No believe dis propaganda machine," Walz write as e dey respond to one Department of Homeland Security post about di shooting.

"Di state go ensure say full, fair, and expeditious investigation hapun to ensure accountability and justice."

Top Democrats, including former Vice-President Kamala Harris and House minority leader Hakeem Jeffries, also release statements. Harris call di Trump administration version of events "gaslighting".

Protests and marches bin hapun for several parts of di city as some Minneapolis residents wey dey vex condemn di shooting and call for ICE to leave.

Inside darkness, dem take dis foto from above wey show plenti pipo wey wear heavy coats and carry signs.

Wia dis foto come from, REUTERS/Tim Evans

Wetin we call dis foto, Pipo gada during one vigil for Good in Minneapolis

Di scene of di shooting na about one mile from wia one city police officer bin murder George Floyd for 2020, wey bin spark worldwide anti-racism protests.

Oda cities for di US bin organise protests, including New Orleans, Miami, Seattle and New York City.

Minneapolis Public Schools bin announce say dem dey cancel classes for di rest of di week, "due to safety concerns". Dis dey come afta federal agents bin reportedly arrest pipo outside one high school on Wednesday.

Why ICE dey Minneapolis?

Di Trump administration bin deploy an additional 2,000 federal agents to Minneapolis area in recent weeks in response to allegations of welfare fraud for di state.

Di mayor tok on Wednesday for press conference say ICE no dey make di city safer. "Dem dey tear families apart, dem dey sow chaos for our streets," im tok.

Di deployment, wey bin start on Sunday, na one of di largest concentrations of Department of Homeland Security personnel for di US city in recent years.

E dey come afta ICE bin launch one immigration enforcement campaign late last year to target individuals for Minneapolis wey dem bin issue deportation orders, including members of di city Somali community.

Dat community don dey criticised frequently by Trump, wey dey call dem "garbage".

"I no want dem for our kontri. I go dey honest wit you," di president bin tok. "Dia kontri no good for a reason. Dia kontri dey stink."

Trump later double-down on im remarks afta one YouTube video by one conservative online content creator accuse daycare centres run by Somali immigrants of mass fraud.

In response, Trump bin withhold federal childcare funds from di state of Minnesota.

Di Trump administration don send ICE agents to oda cities across di US, wia dem don make thousands of arrests as part of wetin di administration say na crackdown on crime and immigrants wey illegally enta di kontri.

Map wey dey show di location of shooting for Minnesota