Wetin we know about di latest coup attempt for Burkina Faso and plan to remove Ibrahim Traoré

Captain Ibrahim Traore

Wia dis foto come from, ALEXANDR KRYAZHEV/RIA/NOVOSTI/ANADOLU VIA GETTY

Wetin we call dis foto, Di kontri security minister say dem dey investigate pipo behind di coup attempt.
Read am in 3 mins

Di military junta for Burkina Faso say dem scata fresh attempt to remove Captain Ibrahim Traore through coup d'etat ova di weekend.

Di junta allege say na di former leader Lieutenant Colonel Paul-Henri Damiba dey responsible for di latest coup attempt – wey dem plan to assassinate President Ibrahim Traore, state-run Radiodiffusion Television du Burkina (RTB) report on Tuesday.

Security Minister Mahamadou Sana say di coup plot involve di "targeted assassinations" of civilian and military officials, beginning wit Traore, either "at point-blank range or by bombing his house."

Di minister add say "arrest and investigation dey continue wey we dey scata dia networks; we go later show videos of dia confession during interrogation of most of di pipo behind dis attempt."

Di military junta allege say Damiba don mobilize soldiers and civilians, wey dem get foreign funding (70 million CFA francs from Côte d'Ivoire) for dis operation.

Both Damiba and Cote d'Ivoire neva comment on dis allegations yet.

Security Minister Mahamadou Sana say "di situation dey under control" wey he advise di kontri pipo say make dem no "mislead dem into dis kind dangerous tins."

Military junta say dis no be di first coup plot against Traoré

Captain Traoré overthrow Lieutenant Colonel Paul‑Henri Damiba in 2022 to become leader of di west African kontri.

But since den, authorities say pipo don plan to stage coups against Captain Traore.

Di latest attempt hapun afta one wey di military govment describe as "major coup plot" for April 2025, allegedly by exiled opponents for Ivory Coast.

Since Captain Traoré become leader through coup d'etat, im military regime bin face wahala including jihadist violence wey displace millions across di region.

Despite dis, Traoré get popular support for di kontri – as im dey preach development wit im pan-African vision.

But critics – foreign and local don accuse Traoré of authoritarianism wey dem say di military govment no dey allow freedom of speech wey dem dey prevent opposition voices.

Di Traoré regime also dey accused of arbitrary arrest of military officers wey dem no dey allow free media.

Dis power struggle inside di kontri don dey cause tension for di West African region.

Di Traoré govment claim in di past say dem find say pipo outside di kontri dey plan to "destabilize" di kontri, especially from Ivory Coast – situation wey don dey cause diplomatic tension.

E neva dey clear how many pipo dem arrest for dis latest alleged coup plot, even though di kontri security minister confam say dem go make di suspects face trial afta dem finish wit dia investigations.

Kontris for West Africa don dey monitor di situation for Burkina Faso.

Traoré im govment also dey face di challenge of how to balance security for di kontri and di democratic transition wey dem bin promise.

Captain Traoré na new chairman of Alliance of Sahel States (AES)

For December 2025, Burkina Faso military ruler, Capt Ibrahim Traore, become di new Chairman of di Alliance of Sahel States (AES).

E take ova di rotating presidency from Mali military leader Gen Assimi Goita during di 2nd Ordinary Session of di College of Heads of States summit wey hold for Bamako on Tuesday, 23 December.

Di summit bring togeda di three AES leaders: General Assimi Goita (Mali), Captain Ibrahim Traoré (Burkina Faso), and General Abdourahamane Tiani (Niger).

For im remarks, Traore bin warn of one severe West African instability, e call "Black Winter" wey e blame on "imperialists" wey dey sponsor militant groups to further destabilise di region.

E also accuse unnamed African "cowardly heads of state" say dem undermine regional security forces and destroy public confidence for di juntas wey dey govern di three AES member states.

E neva dey clear at dis time wetin di Alliance of Sahel States go do about di latest alleged coup plot for di kontri.