Jamb increase registration fee for di 2024 UTME

Wia dis foto come from, JAMB
Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don increase di registration money for dia Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) wey dem go do for 2024.
Jamb na exam wey thousands of young school leavers dey write to fit get admission into higher institution for Nigeria.
For statement, dem explain say di bill for UTME registration wit mock exam go cost $9 (₦7,770 local currency) while di UTME registration without mock exams go cost ₦6,200.
Bifor di price increase, di cost of di Jamb form wey no get mock exam cost ₦5,700 and di one wey get mock exam na ₦6,700.
Di board also tok say di application for foreign candidates now dey for $30.
Jamb dey expected to give more details on top di fees wen dem comot wit more registration gist on or before January 15,2024.
Jamb bin announce di date for di 2024 Unified Tertiary Matriculation Examination, UTME.
Jamb, di body wey dey in charge of di examination to enta higher institution for Nigeria tok say di main UTME exam go hold from 19 April to 29 April, 2024.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di board give dis informate for one statement wey dia tok-tok pesin Fabian Benjamin issue.
Di statement add say registration for di 2024 UTME go start on 15 January 2024 to 16 February, 2024.
Also, dem fix 7 March, 2023 for di 2024 Mock exam examination.
Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Facebook post
Oga Benjamin for di statement explain say dem fix di dates “based on series of recommendations wey come out from one two-day retreat wit Information Technology and Management.
According to Jamb, dem go begin sell dia UTME application document from 15 January to 26 February, 2024.
Di board say dem expect candidates to begin print dia examination slips from 10 April, 2024.
According to Jamb, dem go begin sell dia UTME application document from 15 January to 26 February, 2024. But dem neva tok how much e go cost.
Di board say dem expect candidates to begin print dia examination slips from 10 April, 2024.
Jamb na di board wey dey conduct di examination for applicants wey wan go Nigerian public and private monotechnic, polytechnics, and colleges of educations.






![Joint Admissions and Matriculation Board [JAMB]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/2046/production/_119626280_bbc.jpg.webp)






