JAMB cut off mark 2022 for university, polytechnic and college of education
![Joint Admissions and Matriculation Board [JAMB]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/2046/production/_119626280_bbc.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Jamb
Di Joint Admission Matriculation Board, JAMB plus heads of tertiary institutions for di kontri don fix di minimum cut off marks for admissions for di 2022/2023 academic session.
Di education leaders approve 140 for universities and peg di minimum of 100 for polytechnics and colleges of education.
Dem agree to di decision during di 2022 Policy Meeting on Admissions to Degree, Nigerian Certificate of Education (NCE) and National Diploma (ND) wey dey go on for di International Conference Centre, Abuja, Nigeria capital.
JAMB Registrar, Professor Ishaq Oloyede wey announce di cut-off marks afta votes by di vice chancellors of universities, rectors of polytechnics and provosts of colleges of education say wetin dis one mean na say every institution get di right to fix dia own cut-off mark even to reach 220.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
However, no one go dey allowed to go below di agreed minimum cut off marks of 100 for colleges of education and polytechnics and 140 for universities.
For 2021/2022 academic session, JAMB no approve any cut-off mark.
Dem allow di tertiary institutions to determine dia own cut-off mark for Jamb UTME results.
Di cut -off go be combination of scores from JAMB score, University minimum benchmark, SSCE and practical's wia e dey applicable, dem tok.Prof. Oloyede hama say every Institution get di power to determine dia cut off mark wey be di minimum benchmark.
End of Di one wey oda users dey read well well
Meanwhile one bill wey go allow candidates use di Joint Admission Matriculation Board (JAMB) result for admission for subsequent years if dem fail to get admission for di first attempt don pass di second reading for di Nigeria House of Representatives.
Di lawmakers say dem dey consider di amendment of di bill wey dey contained inside " A Bill for an Act to Amend the Joint Admission and Matriculation Board Act; and for Related Matters".
Chairperson House of Representatives Committee on Diaspora, Tolulope Akande-Sadipe na im sponsor di bill.










